Psquare Shit from mouth

in #busy5 years ago (edited)

PicsArt_11-06-02.19.15.jpg

Psquare just make one kind statement wey dey trend for social media now. The matter get as ein be because Nigerians and Ghana dey see ourselves like big bro and small bro.

Nigerians dey sometimes fight with other African countries o, but Ghanaians na their friends and dem no dey like offend dem, just as dem too dey friendly with Ghanaians.

But dem interview Psquare recently where dem con make the statement wey pepper Ghanaians no be small. According to the Ghanaians wey dey vent for social media, dem talk say them follow support Psquare wey make dem become popular.

I agree say Nigerians na smart people, I no say dem no dey dull at all, but to talk that kind of provocative statement, me I no support am at all.

All of us na brothers and sisters and we no suppose to dey say things wey go pepper another person. Ein get side wey Nigerians smart pass, ein also get side wey Ghana smart pass. Everybody get the area wey him better pass the other person. Na ein make white man talk say, "variety na the spice of life".

If to say Ghanaians no dey support Nigeria, den ein go look like say Nigerians no get outside support at all, apart from their people because, some other African countries no too dey stand by them again.

Ein go good make Psquare mind the way wey dem dey talk about Ghanaians, so dat our two countries go continue to dey relate like big bro and small bro.

The important tori be say, just because Psquare talk that kind of thing no mean say all Nigerians support dem. One love to our Ghanaian and Nigerian brothers and sisters.

I don write finish for now. I salute una.

Coin Marketplace

STEEM 0.36
TRX 0.12
JST 0.040
BTC 70446.49
ETH 3571.68
USDT 1.00
SBD 4.73