21 things not to do on first date

in #naijapidgin6 years ago

DQmUKSUbJf6GJypWe3AotmHNRN95riKkHAk52cqMRqfHJ2x.jpeg

Good morning my country people better day don break for us and I pray say today and every other day go favor us our hustle must pay from our end we salute una.

As we dey always do we don bring one tori come una front yard and this tori na about men dem the things wey dem no suppose dey do or ask for first date wey fit make the shenkes vex or no give them space for their life, and many men dey commit this error unknowingly so we go list those things for una.

Joro olumofin the Nigerian relationship expert and psychologist don share the things on wetin guymen no suppose do for their first date.

1- men no suppose dey look their phones more than the shenkes on their first date.

2-No talk about your bank account or how much your papa get,this thing dey make most ladies vex.

3-Smelling bad(mouth odour body odour).

4-No ask her weda she be virgin.

5-No ask her how many guys she don sleep with.

6-If she go pay anything for the outing tell her in advance no come dey talk say ATM no pay abi u forget your wallet.

7-When your phone ring and person ask where you dey your response no suppose be'i dey with big ass onome or big breast tolu' very wrong.

8-No leave your date go dey talk to another babe very disrespectful.

9-No insist say she must come your house that very day or your friend house.

10-Dont buy too many gifts she go think say you wan buy her over.

11-If for any reason say another person dey inside the car no tell her to sit down for backseat.

12-No ever compare her to your ex.

13-No talk about her weight or her height for example 'you fat or you short'.

14-After first sex weda e bad or good always call her.

15- Make sure you get table manners no talk while food dey inside your mouth.

16- focus your eyes on her not her breast or ass.

17-No present yourself as fake before her just to impress her like borrowing car,cloth or house.

18-Dont be too touchy.

19-No act rude to the waiter or waitress.

20-No ask her for money

21-No ask her for pictures unless na she offer to send to you.

Abeg my people I don drop my own guys and shenkes una fit come add una own join cos we no fit know finish.


Footnote

If you would like to support us,
Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows


Join our discord server for fun, interactions and voice shows here

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

  • Real-Life Talk with @preciousimo
    [Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapidgin Team:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain:
@ogoowinner
@zizymena
@oliverwilliams
@horlaide
@mittymartz
@nmalove
@preciousimo
@rosyblessing


Na @mittymartz design this avatar

Sort:  

Hmmm, this one nah correct advice for men o

No try look another girl ass...?
That one self dey, una well done o.

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.11
JST 0.034
BTC 66137.63
ETH 3161.38
USDT 1.00
SBD 4.13