A whole family wey mad for calabar

in #naijapidgin6 years ago

FB_IMG_1539338586674.jpg
Source: Facebook

My countri people!
TGIF, I dey wish una beta weekend..

Wetin my eye see this morning no be here o. I no fit shout! Na so i just enter facebook see this tori wey dey do me somehow for belle, if to say person hear am come tell me, i no go believe am. But na the main person wey see the matter dey yarn am.

Progress Oberiko wey be corper for calabar talk for her facebook say she see a whole family wey mad. Papa, mama and 3 pikin, all of dem don kolo. She don dey try snap dem picture for 5 months, but finally finally she snap them yesterday. She even talk say dem dey speak better English, she don see dem for market where dem dey buy something, dem dey always waka together for under sun.

I come dey wonder wetin dey make a whole family mad. E fit be say the children no mad, dem fit dey like dat because dem dey with mad parents. If deir papa dey speak better english, dey even go market dey talk better talk, if e be say no be correct madness. Maybe na small metal illness wey psychiatric hospital fit handle. But see the kind countri wey we dey,if to sey our government dey good, dem for carry this family go do test, know the kind madness wey dey do dem, treat dem.

Una don see dis kind thing before? Wetin una think? Na village people abi na small madness?

Make una yarn for comment, i dey wait..

Na @nmalove carry this matter come una domot today..


If you like what the community is doing and would like to support us,

Please follow our trail via
Or delegate SP to @naijapidgin.

We are naijapidgin community with a mission to 'Promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows

Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On @naijapidgin discord channel, a lot of variety shows and lectures are ON

  • Every Tuesdays we have real life issues with @preciousimo
  • Every Wednesdays are unavoidable lectures
  • Every Thursday we have relationship talk with @sparkles
  • Fridays is our well known ameebo center by @rebeccafl
  • Sundays is always variety night show by @itoroarchibong and @imbigdee.
  • Same Sunday we have our @naijapidgin hotseat ( featuring some well known steemians)

You ought no to miss any of our programs.

TEAM:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
@ogoowinner
@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde

IMG_20180319_092844_398.jpg
Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

Ewooo.. LOL...chai!!!
This one na serious matter oo... lwkm!

Anyways thumbs up @naijapidgin ... E be like say i go dey learn pidgin from una oo...e sweet for mouth

This one totori my Belle sha, whole family. E pass village people handiwork. This is global 😂😁😀

This one deep oh.
But how com shey naija no dey carry last for bad torii

Posted using Partiko Android

May God have mercy!

Mehn this story no be small ooo. I believe say the children no mad at all. Them just dey follow their parents footprints. Sai...

Coin Marketplace

STEEM 0.26
TRX 0.11
JST 0.033
BTC 64359.90
ETH 3105.50
USDT 1.00
SBD 3.87