ANOINTING SESSION TURN RAPE SESSION.

in #naijapidgin6 years ago

DQmUKSUbJf6GJypWe3AotmHNRN95riKkHAk52cqMRqfHJ2x.jpeg

My country people una good morning o. Today na another Thursday on top naijapidgin and as e be our manner, we don get another Tori dey wait until for here. Before we yarn wetin we get for una today, abeg make i first ask una, this sun wey dey mamma us for here e reach una side? The way sun dey vex dey beat person eh dey make me wonder wetin hell fire go be like. Anyway make God help person o.

As the matter dey hot e get something wey happen for where I dey live yesterday. I dey my room when I hear people dey shout catch am o catch am o, na so I jump come outside come see as the boys for my compound catch one man come dey beat am wetin tinker dey nak bucket. They beat this guy don't tell anybody. I come dey ask wetin this fine man do wey make una want kill am?

Na there dey take nak me tori. One babe wey my neighbor just marry na im come tell me say the man almost rape am for house. Na so I open mouth ask am how because my compound na so we many and I want know weda he open kolo kolo eye want rape person wife for that kain big compound.

She say na for road she jam o. The man come tell am say spirit of God say make he pray for her make she follow am go him church say the church no far. She come tell am say she wear trouser and she no dey wear trouser enter church. The man come ask am say okay weda she live far from here.she come answer say no say her house no far. The man come ask weda he fit come anoint the house she come accept o na so the man follow am enter compound enter house come begin dey pray dey anoint the house. She come talk say as he anoint house finish he come say make she pull the trouser change to skirt make he anoint her too.

My neighbour wife come enter inside house, according to her as she dey change to skirt na so the man grab her for back want rape am for broad daylight na im babe halla o boys come come out come begin dey pursue am.

My country people, hmm this matter get as e be as people get many questions o. Some say why she go allow man come anoint house she no tell her husband, other say wetin she dey go change to skirt for when he anoint house no be trouser she wear? Some say abi something don happen sef.

Anyway anyone wey e be, make we dey careful how we take dey invite so called man of God make dey come pray for us. No be every boy we claim day God call am na im God call o. Some na them flash God.

Na @zyzymena carry this one come una domot. Make una take life jeje because e no get duplicate.

Footnote

If you would like to support us,
Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows


Join our discord server for fun, interactions and voice shows here

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

  • Real-Life Talk with @preciousimo
    [Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapidgin Team:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain:
@ogoowinner
@zizymena
@oliverwilliams
@horlaide
@mittymartz
@nmalove
@preciousimo

Avarta design by mittymartz.
IMG_20180215_155325_695.jpg

Sort:  

Wawu! Things are happening sha... All in the name of pastor and prayer, we always need to be careful and discerning so we don't fall victim to wolf's in sheep's skin.

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! We encourage and support quality contents and projects from the West African region.
Do you have a suggestion, concern or want to appear as a guest author on WAfrica, join our discord server and discuss with a member of our curation team.
Don't forget to join us every Sunday by 20:30GMT for our Sunday WAFRO party on our discord channel. Thank you.

This na serious matter, but why e come be say na women dey always fall for all this scam of serpents and fraud. Well my own tori na say even the Bible attest to the fact say we be god on our own, why we come allow our own fellow human dey claim dominion over us, abeg make we dey use our head this life wey we dey live dey guided by principles, hmmmm I drop my keyboard.

Na person wey no know God na him day fall inside this kind problem. However make we day careful because thieves Don become man of God this days

Coin Marketplace

STEEM 0.26
TRX 0.11
JST 0.032
BTC 64615.49
ETH 3112.63
USDT 1.00
SBD 3.84