NEW KEKE NAPEP WEY BE LIKE MINI JEEP DON COME OUT

in #naijapidgin6 years ago

IMG-20180913-WA0000.jpg

Source

My country people, una good morning o. How una dey? How una dey hold body? Hope una don register for una PVC? If you Neva collect am abeg make una run go collect am o onto say your vote na your power o. Today na another ogbonge Thursday for naijapidgin and una know as we dey do am, na to bring una beta Tori wey dey happen for we country Nigeria.

Una know say na rainy season we dey and this rain nowadays no dey give person sign before e fall. Wether for change just now before you close eyes, everybody don dey run four forty dey find where dey go hide. If you sharp see Keke na to jump enter the Keke sharpaly before another person go take your position but the worst thing wey go happen to person na make you enter Keke wey no get cover. Your own done well that day.

Na because of this one beta nigerian come siddon say e fit make life easy for Nigerians. This person come make Keke wey be like Jeep with doors and windows and even electric fan wey go dey blow you inside and you dey enjoy cool music. No single rain go touch you until you reach where you dey go.

The Keke fine no be small and e fit carry 6 passengers comfortably nothing go happen. Call am our own made in naija mini Jeep nothing do you. Anyway, this na welcome development. We hope our government go fit support person wey do this thing so that soon e go full everywhere. Even God know say we need this kind innovation for we country.

My country people how una see this kind levels? Na @zyzmena carry this one come give una today o. Remember say life no get duplicate. Everything wey you dey do no forget say life na jeje.

If you would like to support us,
Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows


Join our discord server for fun, interactions and voice shows here

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

  • Real-Life Talk with @preciousimo
    [Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapidgin Team:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain:
@ogoowinner
@zyzymena
@oliverwilliams
@horlaide
@mittymartz
@nmalove
@preciousimo
@rosyblessing


Na @mittymartz design this avatar

Sort:  

Great post @naijapidgin read it and teach something, thankd

Posted using Partiko Android

This innove na good one make I tell the koko. E make me feel proud even the hair for my head dey stand-up one by one cos one of us can try do something inventive.
Gbosa to da person. Gbosa to naijapidgin too.😊
@jodekss

this is so dope... This means good bye to taxi.

Oh boy, e too make sense o
This one sweet me

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! We encourage and support quality contents and projects from the West African region.
Do you have a suggestion, concern or want to appear as a guest author on WAfrica, join our discord server and discuss with a member of our curation team.
Don't forget to join us every Sunday by 20:30GMT for our Sunday WAFRO party on our discord channel. Thank you.

Congratulations @naijapidgin! You have completed the following achievement on the Steem blockchain and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of posts published

Click on the badge to view your Board of Honor.
If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

Do not miss the last post from @steemitboard:

SteemitBoard - Witness Update

Support SteemitBoard's project! Vote for its witness and get one more award!

Dis one make sense scatter!

O Boy! Na bye bye to Taxi be dis ooo!

Abeg, wetin be d name of dis inventor? I go like write full article about am.

Him deserve my accolades!

growth and innovations

Congratulations @naijapidgin! You have completed the following achievement on the Steem blockchain and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of comments received

Click on the badge to view your Board of Honor.
If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

Support SteemitBoard's project! Vote for its witness and get one more award!

Coin Marketplace

STEEM 0.33
TRX 0.11
JST 0.034
BTC 66579.21
ETH 3282.19
USDT 1.00
SBD 4.30