OGA BUHARI DON CHANGE DEMOCRACY DAY,

in #naijapidgin6 years ago


Moshood Abiola

My people my people
How una dey? Hope say una dey enjoy this weather dey cold for night?
As weekend don reach, make una flex with sense o.

For naija we too like holiday, our presido, Oga buhari don change am for us.. E don carry our Democracy day from May 29, wey we do am before put am for June 12. E do am to honor one man wey dem dey call Moshood Abiola, the person wey win 1993 Presidential election. Una know say na Military wey get power for naija that time, for that June 12, 1993 Naija pipoo come pack themselves like say tomorrow no dey go vote the Abiola as dey don suffer for military hand. But the koko be say, Ibrahim Babaginda wey be the military presido no declare Abiola as person wey win the election and e no carry power give am..
Abiola come dey fight make dem give Naija the democracy, Abacha wey come get power after Babangida come arrest am put am for prison, the man come die for prison for 1998.

Oga Buhari come do wetin other presido no gree do, e come give Abiola honour wey dem dey give only Presidos GRAND COMMANDER of FEDERAL REPUBLIC, GCFR come carry our democracy day put for that June 12. Some people get joy as e do am but some people come talk say na election strategy to make people wey dey West to vote am.


Dino Melaye
Senator Dino Melaye, that Senator wey dey talk wella come dey challenge Oga Buhari for Senate meeting. E dey talk say dem no suppose give Abiola GCFR honor, say the man don die and people wey don die no be Nigerian citizen again. E come bring constitution come dey quote plenty plenty things, say Oga Buhari don break law wey dey for constitution, go give person wey no be citizen that honor, say make Buhari withdraw e statement. I come dey wonder, if Nigerian person die, e citizenship don expire? How people go address am? dem go bury am for another country? The matter tire me, no be lie.

Abeg make una help me chook mouth for the dis matter o, i no understand again o..
Una believe say wetin Buhari do dey good?
Una think say na election strategy?
If person die, the person citizenship don expire?

Make una help me talk oo..

If you never enter or discord, join for here

For we discord channel, beta dey happen

Every Tuesday na real life issues with @preciousimo
Every Wednesday na lecture
Every Thursday na relationship talk with @sparkles
Fridays na ameebo center by @rebeccafl
Sundays na variety night show by @itoroarchibong and @imbigdee.
Same Sunday na our @naijapidgin hotseat

You no suppose miss any of these ogbonge programs.

If you like wetin we dey do, join our curation trail

Na @nmalove carry dis tori come.
DQmQkNYBpYh7mPEJV6KFqxCfneCsy8kYxgzH7Lg91z6zf7o.jpg
Na @mittymartz design this avatar.

Sort:  

Hmmm... The matter tire sef sef o. How Oga Buhari go declare two public holidays for the same event twice in one year. Me I feel say na political move to make south west support am for 2019.

If him get true intentions, him for just make the announcement to take effect from next year. But e no go favor him 2019 ambition.

God go help us for this nation o...

I hail una @naijapidgin

This one na strictly election strategy. Even if he carry all d award gv Abiola. He go still lose west

Coin Marketplace

STEEM 0.35
TRX 0.12
JST 0.040
BTC 71539.00
ETH 3603.23
USDT 1.00
SBD 4.75