Relationship for Naija

in #naijapidgin โ€ข 6 years ago

๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹
My naija pipu, beta pipu, correct pals, hw una dey.
Hw una weekend dey take be, hope say unah enjoy d free day of d week..

@naijapidgin talk say make i grit all of unah "good morning " say im dey wish u a stress free week ahead
How hustle, hope say na pray n work u dey carri all dis level do. We pray say all go sama well veri soon
.

For dis kind gentle morning wey i don dey plan my daily activities, na im i hear one kain noise for my neighborhood, my head for turned around say which kind wahala be dis. Na after i comot my room, na im i see say na relationship mata dey twerk ' dey sup' for d place.

Na relationship mata @naijapidgin carry come our domot today, make una follow us reason dis mata bcos we don see say some marriage don dey too old. So hw we fit shuffle things 2geda....

IMG_20180514_074740_030.jpg

   ๐Ÿ‘ซ๐Ÿ‘ช๐Ÿ‘ฌ๐Ÿ‘ญ

Wetin be relationship (marriage) self?.

Relationship na d union wey dey sup btw two pipu of opposite sex. As relationship dey, it works with marriage.
And we don see say marriage na d mutual agreement wey dey puyeke btw man and woman dat ar tied 2geda.

So d arising mata wey dey dis discussion be say some marriages don old wey be say na evriday quarrelling. Without polygamy self, dem no get peace, and divorce come be like taboo.. Nawa oo. Wetin man go do for dis kain country wey be say ur wife tire u. Instead say make u turn her to punch bag, divorce letter self pay pass all dis. Bt wetin dey pain me pass be say d wife go wan turn mario ,dey talk say na d father of im pikin get am.. Deadlock.......

@naijapidgin views ๐Ÿ™‹๐Ÿ™‹๐Ÿ™‹

Dis relationship mata wey dey puyeke for we domot no be new thing...
Wetin i dey suggest be say if naija fit stick to all dis yankee pipu style wey be say marriage go dey base on contract. Maybe 10yrs of marriage + 2 pikin, and if u see say u still dey happily 2geda, u fit extend am..
Bt dis kind thing get demerit sha bcos say for naija here, i swear bastards go full ground like sand.
.

As d mata don be::::
Ma naija pipu, hw we takr see am
hw we take reason am,
Wetin we fit do to solve all dis kain relationship ๐Ÿ’๐Ÿ’ mata
.

Abeg make we cbuk mouth for dis mata..

No forget to join d @naijapidgin whatsapp link via

Na @horlaide carry dis post come we domot๐Ÿ˜๐Ÿ˜

IMG_20180319_092844_398.jpg
Na @mittymartz design dis AVARTAR..

Sort: ย 

Beta post wey talk about how pipu for relationship go take manage there relationship life, I take look the post, me fall ya Lara on top for the post. Thank you beta @naijapidgin I be @peakreal1 and I like nijapidgin

@peakreal1, much thanks to u
@naijapidgin likes u
Nice post ๐Ÿ‘๐Ÿ‘๐Ÿ‘

Omo dix relationship mata e no easy oo for any were self, i hear say Nelson mandela slf fit endure 27yrs for prison oo but e no fit last 2yrs for him marriage. Even d oyibo people dem own nai worst pass oo, this naija own na mostly misunderstanding sha and lack of patience,

@urchice
Misunderstanding for Relationship na d main prob. wey dey lead to fight nd all kind vices
Well u don try for dis mata.
Nice ๐Ÿ‘๐Ÿ‘๐Ÿ‘

Hahaha
Good morning o my piple
How you go turn marriage to contract, na that one crazy pass.
You see for this area way i dey soo, na so so shout everyday for husband and wife oo.
You see, understanding matter big time for any relationship ooo.
But wetin me i see soo be say 50% of this marraige way they they beat there self, the majority be say the husband no pay the bride price, se u dey get me?
Number two be say, the wife use belle tie the man for ground. So mutual understanding no dey, love no dey.
They just gather they commit fornication.
See na only God fit help us oo, for all these relationship matter oo

Me i just dey pass by oo
Una welldone oo

True talk
Thanks @rebeccafl!!!!!
Understanding play one kain ogbonge role for relationship
Nice ๐Ÿ‘๐Ÿ‘๐Ÿ‘

This relationship mata sef don taya me
But i don't agree with turning relationship to a contract though....

Lol, woman woman
Sha marry person wey sweet u
A litu advice......
Nice ๐Ÿ‘๐Ÿ‘๐Ÿ‘

@naijapidgin Your post make sense no be small o.
No talk say make naija people adopt oyibo style o,you no say we sabi overdo well well,anything wey naija people put hand don spoil be that. Wetin important pass for relationship na make understanding dey.
Make we dey manage ourselves laidat las las we go dey alright.

Una welldone
U don try for ya comment
Nice ๐Ÿ‘๐Ÿ‘๐Ÿ‘

Lol, I de laf base on say if marriage turn to contract, we go de begin marry like 50 husband or wife b4 we kpaii o. Men go make am 2, 2, yrs with 1 woman ๐Ÿ˜‚ Lik this a man go marry 5 wives inside 10 yrs. My people this no make brain o.

Lol, thanks say u reason well wit @naijapidgin
Bt base on logistics, arguments no fit dey..
Nice ๐Ÿ‘๐Ÿ‘๐Ÿ‘

Me oh I no like the contract tin wey yankee people dey do for me make person marry who hin love to avoid all this wahala for relationship abeg.
I wan see love weh dey puyeke all over

@eunireal1
Wen it don come to relationship mata, i go always respect uu
Nice ๐Ÿ‘๐Ÿ‘๐Ÿ‘

I throway salute give u @naijapidgin
E no be new thing say some relationship wey dey group naa 'puyeke'....i never dey any relationship yet because me i no wan any goru goru, u do well to yarn us this piece....Thumbs up

@vickyrich
Nice post ๐Ÿ‘๐Ÿ‘๐Ÿ‘

Congratulations!,@naijapidgin Your post has been upvoted by @naijapidgin for using the naijapidgin tag


Support @Naijapidgin By following the Curation Trail (https://steemauto.com/dash.php?i=15&id=1&user=naijapidgin)
Sponsored By @ogoowinner

Nice ๐Ÿ‘๐Ÿ‘๐Ÿ‘

@therealwolf 's created platform smartsteem scammed my post this morning (mothersday) that was supposed to be for an Abused Childrens Charity. Dude literally stole from abused children that don't have mothers ... on mothersday.

https://steemit.com/steemit/@prometheusrisen/beware-of-smartsteem-scam

Nice ๐Ÿ‘๐Ÿ‘๐Ÿ‘

Coin Marketplace

STEEM 0.35
TRX 0.12
JST 0.040
BTC 70887.21
ETH 3581.98
USDT 1.00
SBD 4.75