Take life jeje, No hurry in life

in #naijapidgin6 years ago

JPEG_20180518_163148.jpg

Una good morning my country people, i sure say una dey flex this new week as e be say this weather na weather for T**.... Abeg na tea I mean

Matter wae meet us today na true life story and infact e touch.... First make we talk about hurry hurry for this life hurry to bath, hurry to work, hurry to this hurry to that, where we de hurry de go. Life no b competition and everybody get time to shine a d if na your time rub Vaseline make you shine wella but watin you think if person see him friend wae them follow commot for school and you come see say he come buy motor and you de feel like say na the same one head una get... Remember say you know know watin him do to reach there and you fit ask.

This morning matter wae reach me on top my bed about 2 of my secondary school friends oo... One don blow and one wan blow. So matter na say the one wae don blow don buy car buy house and everything, una know how e b for Naija now, na young boys de drive expensive cars now, this my friend come to meet the other one say how far him take blow, nai that one tell say him de do business and him no gree tell am the business but as e continue de ask am, he come give am the gist how e take happen na so my guy shock about the tin but him say him go do, so them come go for the juju man place where them go do am, him agree say e go do anything, the juju man come say make he kill anybody wae him see for mirrow and na so him mama show for the mirrow and him say him na go kill him mama, na so him start to de sick oo, him friend come carry am go hospital go there and him no talk watin happen and after this my guy talk this story how him take reach hospital him come die

So my own na say life no be competition, if my own good today no mean say your own suppose good today... Make una take life jeje

If you like what the community is doing and would like to support us,

Please follow our trail via
Or delegate SP to @naijapidgin.

We are naijapidgin community with a mission to 'Promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows

Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On @naijapidgin discord channel, a lot of variety shows and lectures are ON

  • Every Tuesdays we have real life issues with @preciousimo
  • Every Wednesdays are unavoidable lectures
  • Every Thursday we have relationship talk with @sparkles
  • Sundays is always variety night show by @itoroarchibong and @imbigdee.
  • Same Sunday we have our @naijapidgin hotseat ( featuring some well known steemians)

You ought not to miss any of our programs.

TEAM:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
@ogoowinner
@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde

IMG_20180319_092844_398.jpg
Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

To add to wetin boss don talk, everybody destiny dey different no think say your friend quick blow meaning say your time no go reach, just continue to work hard cause baba God dey see everything and his time is surely the best...

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

Him for don wait na. Na everybody get better destiny oh. That wan wey jump before hin time, for come later reason the guy say how e take do am. No be now wey him go come dey talk as crayfish bend wey him mama cry

True talk naijapidgin na Nigeria them suppose they call Russians una do well.

Okay my person thank you say you put mouth for we matter

@naijapidgin see that peer pressure tin na we de reason am like dat...see our people dem foh house na them suppose encourage our smallie them say life na jeje.....see wen i small my maale bin let me kwn say if people steal escape if me i do am i no go escape..shey u the feel me dat na based on make fear for dey so i go do the right thing....omo our parents need work hard. Na my contributete be that

Coin Marketplace

STEEM 0.26
TRX 0.11
JST 0.033
BTC 64507.66
ETH 3080.07
USDT 1.00
SBD 3.85