UNA DON HEAR OF NAIJA.HEALTHCARE?

in #naijapidgin6 years ago

My country people anoda Thursday don show again. How una dey? How the month dey treat una? I believe say this month go better. Rain dey fall well well now o so if you no want make e beat you, always carry umbrella dey Waka.

Unto the matter wey dey for ground, una know as we dey do am now, naijapidgin dey always carry beta story come una domot. Wetin we carry am today? Na beta thing wey want happen for steemit block chain.
image
Una don hear of @naija.healthcare? No worry if you never hear about am, I go tell you wetin e be. For we country, e don tey wey e dey happen no be today say person go go hospital because he sick well well and at the end them go carry ogbonge hospital bill nak am tell am say if e no pay, dey no go discharge am. The one wey bad pass be say the more the person dey the hospital the more im bill dey increase.

Na im some beta people come reason am say instead make we dey use Steemit dey make money for only we sef, e go still good make we use am make money help people especially people wey money wey dey their hand no reach pay their medical bill and im Dem come start this beta blog so wey Dem call @naija.healthcare.

No dey here dey ask say how dis one be now for we country. Oya make you rush go their blog www.steemit.com/@naija.healthcare. for there, Dem explain how every every want take be. You fit still join them for discord for this link

You like the project as me sef take like am, den make you support them. @naija.healthcare get we people for mind. E no good make you forget where rain first beat you.

Na @zizymena carry this one come o. You like wetin we dey do? Oya join us for we discord server

For we discord channel, beta dey happen

You no suppose miss any of these ogbonge programs.

You fit still join our curation trail

image
Na @mittymartz design we avatar.

Sort:  

i don hear ooo he better pass anything.... i hail una for the ogbonge work🙏😉

Correct! Nah you sure finish we happy say u Don hear so you go help us spread the news of this better thing wey d happen for we naijapidgin

yes o... the news na confirm infact does wey never hear go hear well well..... una d best for this steemit oo... i salute

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

omoh I don hear o, na better thing una dey do.
Una try, ma God continue to dey bless una for this one o.

GOD go bless you too say you come put mouth for this matta and make you no forget to d carry d news Waka.

Coin Marketplace

STEEM 0.26
TRX 0.11
JST 0.033
BTC 64507.66
ETH 3080.07
USDT 1.00
SBD 3.85