LIFE EXPERIENCE ON BLIND DATE

My obodo naija pipu I comot cap give everybody o. I greet everybody this sweet morning, as baba God just drop rain for our side today o. Everywhere come Culele like say na whiteman land i dey.

i too padu this ogbonge contest wet our big community @naijapidgin carry come outside o, say make everybody dey shan wetin him koro koro eyes don se for blind date. Make I run gist my own tori for dis matter.

heart-3071961__480.jpg
image source

THE BLIND DATE

As the ajepako wey guys be then, wen person dey live with den mama and Papa for one kind big house 'face me i face you ' compound then. Everybody go get one common kitchen for the whole woman, know separate toilet or bathroom. Inside the next compound wey dey next to our own, one fine yellow babe dey that compound. Every young bobo for that area just they find how to make dis girl be him own. Wetin make me come like the girl die be say she sabi book ehhhhhn and she come like God join. Omo see wife material ooo, as gentle guy wey i be nau, to go face the girl yan beta say i lovi her my liver know gree go. Even for dream to see the girl na wahala. Because den, I be get one go talent, any girl for area wey we want but to go toast her na wahala, guys go just chill till midnight, use the girl mata sleep, i tell you the babe go show for dream. Life na for stages o, most of my padi them den go dey yan we say dis girl I done see everything from up to down, but ask am wen be all dis happen nau, I go hear person they tell me say last night for my dream na me and she they get romance o for inside wata, oboshe for them, spiritual wife done dey call them be dat.

The babe name na Tola, one day I come plan my way to take be her friend. Na so I start to dey go their church, i follow join choir oo,every Saturday na me dey go call her for rehearsal. No so me and the girl come close we come be best of friends. Omo guys for area come dey ask for the manual script how i take get the babe, because everybody think say i don dey date her. Even Sunday i dey quick go church. Service na 8am but me go reach the babe house, dress wela at around 7:25am. The parent come like me say me love go ooo,you know dat kind thing nau, her parent go even they talk am say they go like make i be their pikin husband, I go just throway face like, mummy like the will of God be done, make i hear know be for my church mind o. May the parent serious about the mata or na play play i know sabi, wetin i know be say i like Tola.

During that time, one ogboge FM every Saturday always dey do, met your spouse. The program i always dey padun am, because he dey sweet die.many pipu done meet their wife through the program and some na the other thing they see. They go fall for sharp guy hand wey go just use dem dump dem and carry go. That night i say make i follow join. I drop my number give the presenter dey pray say make one fine girl just choose me. Because you go drop your details the kind girl you want, the girl too go do the same thing na from their den they carry merge too people. After the program i just see one strange number call me, I pick am. See wetin we yan oooo.

Caller: hello

Me:Hi,who I dey talk with

Caller :it's Lizzy

I come think, Lizzy i know sabi that name. I done like am already because of the sweet voice i hear

Me:Lizzy,from where

Caller:i get your contact from, search for spouse program on FM

Me:i come set wela, OK me too dey expect to dey hook up with person.

we talk for about 30mins go arrange how to meet for one eatry on Saturday to make our meeting perfect. Through the remaining days i know fit sleep, na how i go take get liver approach the babe, wetin to follow the babe yan, where to gather money entertain her to know say guy hold side too. Less than five (5) days to prepare. I borrow moni from my fellow guy's, buy beta shoe, T-shirt with one other watch join spray to smell good. The day come show, I run at least 30min early before the meeting. As i sit-down dey sip my coke na so I see wetin my eyes no fit believe. I try clear am if na dirty cause am but na the same thing i still dey see. I see my own Tola dey enter the eatery. I come form. The babe come fine they more like spirit. She enter, I first think say na something she come buy. As she see me, she come sit near me ask me wetin i they do for there. Na so I lie say, he get one soul i want preach give for there, she say hmm, but see the wey I dress, I come quick quote proverb give her say "dress the wet you want to be addressed '. Dat one enter me too come return the question say wetin she too dey fine. She too come lie give me. The same lie, she get person she want come preach give. Na so we both sit-down dey wait for our new brethren. As she get up to call the person na so this my China phone just ring, she come surprise, but she know show am, me too lock up I know pick, she call again about twice she come discover na me be the Jack she they wait for and me too come see say she be the Lizzy i they wait for. We both lie and hide our names on the program not to reveal our identity. Omo they rest na tori for another day. I rest my case. Thanks

Sort:  

This is so interesting buddy, ah! Sorry its a pigin things. 😂

My brother you really try no be small, this kian still make our country one of the best places to be. See as pigin dey sweet person body. 😁

my oga na true talk. Our own lovi lovi dey different from oyibo own

My paddy, you try well well so...see as you dey talk am like say pigin english dey your blood.

na for naija i grow. I be local breed and not all dis agric breed

Coin Marketplace

STEEM 0.29
TRX 0.12
JST 0.033
BTC 63464.16
ETH 3111.33
USDT 1.00
SBD 3.98