"Pack Your Sub"(in vernacular)

in #witness5 years ago

Black Chalk:
You be atheist but your name na Ruth,
Peters your surname; that na confirm truth.
Last last, mumu don rent house inside your brain,
soteh you see hot sun begin call am rain.

Artitude:

You no like God but you deh praise am for every post;
shebbi you be atheist weh deh use Bible pose?
I wonder wetin you deh find for inside church:
Just to hear wetin pastor talk, make you for judge.

Talking Pen:

Because the cripple na Muslim beggar you sey u no go fit give am your holy money,
but na your "Love your neighbour as yourself" sermon dey first slap my ear wake every morning.
"No heaven, no hell, who don die don die, wetin you dey fear?"
But yesterday wen motor dance small gwara-gwara your "Blood of Jesus!" almost deaf my ear.

Wait, bring your head make I shoot sense put;
E no go take time, just like your ‘quick short put'

Artitude:

Choir Mistress, you no fit follow sinners talk.
Your ways too pure, you no like sex talk; virgin Mary, you be 22
you still dey treat malaria with Postinor2?

Black Chalk:

Aunty, oya clap for yourself;
to be honest, me I'm so impressed.
So you know all the hotel with spoil spoil A.C,
anointed prayer warrior, I gbadu your allnight praying.

Talking Pen:

Kontriman, e don reach time for me and you to pull dis dirty pretence agbada.
How pastor go tell me say holy spirit sey make the church fast and him teeth dey machet akara?
No man is perfect; every sane soul with im own special kind of crase.
But make we be our true selfs, no need to dey form two face.

Wait, bring your head make I shoot sense put;
E no go take time, just like your ‘quick short put'

Black Chalk:

You be feminist, you still deh ask for T.P
I think say for gender equality na you be H.O.D
You deh condemn asahwo but na man deh give you bread
Wetin you don do other than to spread for bed?

Wait, bring your head make I shoot sense put
E no go take time, just like your ‘quick short put'

Talking Pen:

We don tire for this old selfish sicklers, we need fresh and brilliant blood to pilot we kontri"
But wen Sowore stretch hand give you, you sey you no fit shake hand wen kom empty.
For their mega rally for Warri last month I see one politician dey share five five K from one green Ghana-must-go.
But very fat "Say No to corruption," dey smile for back of him holy white party polo.

Artitude:

Mr pefect; Oga critic
I hope say your own crib-thick?
No dey live for empty page
Come dey criticize guys with heavy rage

Church boy...
You no like circular videos
Say e no dey motivate...
Buh inside church nah you dey multi-date
Fornication nah sin buh you still dey masturbate.

You still dey watch those spiritual videos for pornhub?
Wait, bring your head come make i shoot sense put
E no go take time just like your 'quick shot put'.

53397864_890552131275834_8470894672833675264_o (1).jpg

Sort:  

Congratulations @nathan123! You received a personal award!

Happy Birthday! - You are on the Steem blockchain for 1 year!

You can view your badges on your Steem Board and compare to others on the Steem Ranking

Do not miss the last post from @steemitboard:

SteemitBoard - Witness Update
SteemitBoard to support the german speaking community meetups
Vote for @Steemitboard as a witness to get one more award and increased upvotes!

Coin Marketplace

STEEM 0.33
TRX 0.11
JST 0.034
BTC 66438.74
ETH 3268.32
USDT 1.00
SBD 4.39