If you want money, which type of people you suppose dey mingle with?

in #busy6 years ago

A very mighty salutation to all of una wey read my previous post. Today I want yarn about this thing wey some of us dey do, and some of us dey fear to do. I ask say, which people e good make you dey mingle with it when you broke and you really want to start to make money?

I sabi wetin dey run through your mind now. Some go say e better make you start to dey waka with rich people, some go still say your close associates no matter at all. Well, wetin me I want talk be say, if you don look your life finish eh, and you don truly think am say you want to see change, e go good make you begin to look for wise men dey hang around them.

Sebi you understand me? I no talk say make you go meet rich people o! I talk say wise me. Wetin make me suggest wise men be say, anything fit make anybody rich by chance, but every wise man reward na riches. Sey you grab my point? Luck, Inheritance, Lottery and other things fit make anybody rich, but the best way to attract riches to your own life na to attach yourself to wise people.

I believed say una don learn something from our today tori. Una doh o!

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.13
JST 0.033
BTC 61959.02
ETH 3004.67
USDT 1.00
SBD 3.59