You are viewing a single comment's thread from:

RE: I will delegate 6000SP to 12 "real minnows". WHY? Because, I Feel Blessed!

in #delegation6 years ago (edited)

My country people una good morning o. Make I first trowey salute give big bro @ejemai for this wonderful opportunity wey he carry come to help minnows for steemit block chain.

You surprise say I dey write for pidgin language? No shock abeg na because na we Dem dey call the @naijapidgin community.

This community never tey wey e dey exist and we don grow to reputation of 53 with almost 400 followers. Why we need this delegated SP?

If you look around steemit block chain you go see say many other countries Dem dey express themselves for their languages and even at that Dem still dey get ogbonge support from the people. Na im somebody think am say as naija be multilingual country, e go good make we get one language wey go unit all Nigerians for steemit. One language wey we go fit use dey express ourselves. One language wey we go take dey write post dey jolly and cheetah or steem cleaner no go ever visit us and na im we take born @naijapidgin.

Since naijapidgin come na so so smile e dey put for him followers face. We dey discuss matter as e concern we country dey rub mind together,we dey keep we people updated with latest happenings for we country. Our WhatsApp group no get I be this or I be that, na central meeting place for people from different communities and na so we dey share plenty gifts, ogbonge recharge card and na from the post payout we dey do all these things. Every week we dey organize contest dey share SBD.

The thing wey dey pain us be say our people no fit dey write post with naijapidgin because we no get the much needed SP to dey curate the beautiful post wey dey go write. Even the comments wey Dem dey drop for we post, we no even dey get SP take curate am but we believe say if we get this delegated SP e go carry us go far and people go know naijapidgin,people go still know naija.

Help us build Nigerian and help Nigerians. Help us give people the freedom to express themselves in a language they feel most comfortable with. Help us promote the pidgin language on steemit block chain.

500SP will do this and more. Thank you @ejemai and @mosunomotunde

Sort:  

@naijpidgin thus deserves this 500 delegated SP to encourage her followers.

I hope my 9ja pidgin community wins oh

Naijapidgin una gbaski

i hope say we win oo... @naijapidgin

Talking about originality, that's @naijapidgin.
One of the communities I didn't regret ever joining.

Okay, I don dey form self. Make una just check the blog, see wonders. Naijapidgin too much abeg.

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 66149.24
ETH 3015.59
USDT 1.00
SBD 3.73