MY NPC ENTRY WITH @agoowinner : WETIN FRIENDLY ENEMY DON DO ME FOR THIS LIFE.

in #friendlyenemies6 years ago (edited)

images(5).jpeg
#faceMeifaceyou (source: google)
Me be one kind person wey be say if me - you no gel, I no go let you carry your leg enter my doormot. friendly enemies be one kind people wey you no fit avoid, dem standa gidigba dey wait you anytime. nah dem fit winch person pass and u no go fit confront dem. U go meet dem for plenty plenty place. in fit be for work, church, mosque, even for family self. in mean say dem be people wey dey very close to you. As I be sharp guy I no go watch person dey pour sand for my garri. this kind matters carry serious caution, make dem no see my back at last. You no need dey fight anybody. I Don talk say the matter carry caution for hand.
One thing you go do be say, person go dey careful of who you open mouth tell your personal matter too. if you no quick adjust on top this level wetin you think say nah secret don become public Tori. this mouth dey very powerful, cuz were leg no fit Waka reach, mouth Don reach dere spoil am for you already. As in be say Dem be friendly enemies in get were dem too go fit useful, so nah wisdom you go use handle thier mata. so no go sleep, shine your eye well well. if dem too see say your eye open like Segun Arinze own, dem no go one trespass. Me Don try talk wetin me no about Dem ooooo. Make i cover the rest for pot.
@agoowinner this concept Nah confam, no be duplicate Oo.

images(6).jpeg
source: mark angel comedy.

Sort:  

Pidgin English on point.
Hehehe.
Thanks for sharing.

You fail the game o! We said Nigerian photo.

Abeg make I no fail oo. check am again I Don package another photo give you.

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.12
JST 0.033
BTC 70013.82
ETH 3766.83
USDT 1.00
SBD 3.80