SAY NO TO DRUG ABUSE

in #naijapidgin6 years ago

drugs-647_061016034407.jpg
Image source

Na so I dey my house this afternoon oh boredom won kill person so na so I say make I go one side go see how things dey go, so na so I enter one bar wey no far from my place. My people waiting I see my mouth no fit talk am finish, na so I see some boys and girls just dey mix mix different kind of drugs inside the alcohol wey dem dey drink na so I just dey look dem oh.

Olamide-and-his-Shaku-Shaku.jpg
Image source

Dem come dey dance shaku shaku as if na dem teach Olamide the dance. Na so I come ask myself say weting dis Nigeria don become abi everybody na doctor na becos I nor come know again oh, dem come dey call demselves science student...Laugh no go kill me. Abeg I won beg we youth wey dey our country say make dem take am easy with all dis drugs becos life nor get duplicate oh. Dat na weting I say make I talk about today oh.
HAPPY SUNDAY ALL

DQmYfKYGX2M8Qc8nNUi6TqUzHKoeLmafZ6PVBMjt7wjXe5R (1).gif

Sort:  

@Gabowisdy, thank you for using the naijapidgin tag.

We encourage and support minnows.

Join us on discord: https://discord.gg/5SR8CH4 for more fun and to submit your posts for curation.

You like what we are doing and would like to support us? Join our trail here: https://steemauto.com/dash.php?i=15&id=1&user=naijapidgin

Coin Marketplace

STEEM 0.26
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 61133.31
ETH 2887.29
USDT 1.00
SBD 3.64