45 YEAR OLD MAN WEY RAPE SMALL PIKIN

in #naijapidgin6 years ago

9defd2d3ae0a5a88e14978c579aabdf8.jpg
Source
My countri pipo!
How una dey?

TGIF!! Make una flex with cautiono.

I just dey read tori wey full one amebo page for instagram, dem dey all Instablog9ja, I come see one tori wey shock me. I say make I carry d matter yarn naijapidgin make we reason am, make we open eye wella.

One woman wey e name na Marlene, dey talk say e family friend we dey live for one Estate wey dey for Ajah, get one 5 years old pikin. One man wey dey 45 years old carry the pikin, rape am. The matter shock me, wetin d old man see for the 5 years old girl body, wey go make am rape am? Why people wicked like this.

For this we countri, if dem rape girl, people go begin talk say d girl wear indecent cloth wey dey show her body, na wetin make dem rape am. Society go dey judge d girl. Now wetin society wan talk for this matter, dis one dey 5 years old, she never dey grow breast, she still dey wear baby cloth, so wetin the man come see for e body..
Dey arrest d man, e come dey bribe policeman to release am, i tire for we countri. I pray say police people go do their work wella.

My people make open eyeo, make we no dey free our small girls with uncle dem. If you get girl pikin, sister, cousin wey dey close to you, dey monitor am wella.

Oyibo talk say PREVENTION IS BETTER THAN CURE...

Wetin una think? Una don hear dis kain child rape matter before? Abeg make una drop am for comment sectio, make we learn.

Na @nmalove carry this matter come una domot today..


If you like what the community is doing and would like to support us,

Please follow our trail via
Or delegate SP to @naijapidgin.

We are naijapidgin community with a mission to 'Promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows

Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On @naijapidgin discord channel, a lot of variety shows and lectures are ON

  • Every Tuesdays we have real life issues with @preciousimo
  • Every Wednesdays are unavoidable lectures
  • Every Thursday we have relationship talk with @sparkles
  • Fridays is our well known ameebo center by @rebeccafl
  • Sundays is always variety night show by @itoroarchibong and @imbigdee.
  • Same Sunday we have our @naijapidgin hotseat ( featuring some well known steemians)

You ought no to miss any of our programs.

TEAM:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
@ogoowinner
@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde

IMG_20180319_092844_398.jpg
Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

Na wa o
Wetin this world dey turn to sef..
They better castrate tat man.

Lol i no even dey suprised self e Don turn norms for niger

Coin Marketplace

STEEM 0.30
TRX 0.12
JST 0.034
BTC 64455.55
ETH 3147.84
USDT 1.00
SBD 3.94