Drug Abuse

in #naijapidgin6 years ago

Ma Naija people how una dey, I trowey salute give una oooo.
Make una welcome to our ogbonge naijapidgin blog.

Hope say una weekend waka smoothly, I know say una go party all thru d weekend eventhough SBD price no gree. @naijapidgin dey wish u more blissful week ahead.

Today, we wan discuss wetin dey educative, hw we fit enlighten we self on mata wey concern health.

Drug abuse be one kind ogbonge public health palava wey dey affect most communities and families self in some ways.
IMG_20180416_110310_628.jpg
Wetin be drug abuse?
Drug abuse fit be d misuse of drug or make we use drug without consultation. It fit be the excessive use of drugs also.
Abused drugs
Cocaine
Methamphetamine
Anabolic steroids
Club drugs
Heroin

As una know say the side effect of dis drugs don dey affect dis country big time, leading to chronic effects like:
Mental palava
Drownsiness
Behavior wey no fit d society.

Some dey even talk say using drug without consultation na abuse. Na dis one I disagree, so person wey get headache no fit use common paracetamol again ,nawa oo.
But d one wey dey worry me pass na d issue of all dis pain killer, like
Really extra, chakapain, tramadol etc. Wey me believe say na sikent killer.
I know say all dis abuse something get good side but we no go chuk mouth for that area make all of una no go dey abuse drug

As u don understand and digest dis mata.
@naijapidgin wan make una talk;
How drug abuse don affect u?
The advantages of drug abuse wey una know?

IMG_20180319_092844_398.jpg
Na mittymartz design dis avatar

Sort:  

Drug abuse na really bad tin oh, see as e dy effect life

Sure na
I no know y educated pple still dey abuse am self

Nice!

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

This drug abuse no be small mata oh, pipu conscience don kpeme for the anyhow drug wen take, dem no dey pity for dem self, even so pipu don kolo for the mata. Our musicians make everitin worse, go dey sing about drug like say na beta thing. With way tinz dey do for this drug mata, our generation no go live long oh

Nice @eprolific
U don yarn beta for dis mata

It is really wrong to abuse any class of drug be it opioids, narcotics, NSAIDS, steroids, antibiotics etc.
If you have got a headache it is easy to get paracetamol because your aware it is an analgesic but now some persons just buy it and take an overdose unknowingly without asking for the appropriate dosage.
It is important we all stay away from abusing drugs.
The side effects and adverse effects from this might be a long one.

@eunireal1
You don yarn beta for dis mata
And drug abuse no wan gree commot

Some people go they talk sey who that one affect. But the thing don eat deep into our society na only God fit commot person from this kind of matter oo

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 62423.21
ETH 2897.82
USDT 1.00
SBD 3.56