Who be this guy? (a bible story in pidgin) #2

in #ni6 years ago (edited)

Sea.jpg
image source

"Guys mo na come out make we go. Bros J dey wait us outside"
Na James go call the remaining disciples wey dem still dey wait outside.

Many people don wait for road for Jesus. Plenty people wey sick na him he heal. As he dey heal them, he dey tell dem make dem repent because God's kingdom go soon show. He tell dem one story, wey him call parable of the sower. Jesus like to dey use story explain him message, na because the people like to dey hear story.

Dem waka leave the people enter bus wey carry dem reach Galilee Port. Na boat go take dem cross the water to Gadarenes. Na one cabin cruiser boat dey enter, as dem settle down, the boat driver start the engine. As the boat move, Jesus enter inside one small room wey person fit lie down. He tell him disciples say he wan go relax small. Small time, sleep carry Jesus as he lie down.

He never reach like 30mins wey dem leave the Port, wey one kind strange storm start. The wind heavy so tay water dey enter the boat. E be like say the boat wan sink.
"Na here person go con die? Me wey I no fit even swim. My own don finish!" Na so Mathew start to dey cry.
Others dey shout. Peter, John and dem brothers dey try use their experience for fishing take help the matter, but the wind too strong.

"Where Bros J dey sef? He wan leave us here make we die? He no hear our shout since?" Na so Judas talk.
Na so two of them go wake Jesus up, say "Bros J, you still dey sleep? Na die we dey so. The boat dey sink!"

.....................

read part 1 here

)

Sort:  

@Popet, thank you for using the naijapidgin tag.

We encourage and support minnows.

Join us on discord: https://discord.gg/5SR8CH4 for more fun and to submit your posts for curation.

You like what we are doing and would like to support us? Join our trail here: https://steemauto.com/dash.php?i=15&id=1&user=naijapidgin

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 61383.17
ETH 2915.78
USDT 1.00
SBD 3.61