Who Be This Guy? (A bible story in pidgin) - #1

in #nigeria6 years ago

Jesus and disciples.jpg
image source

"Judas, Judas! guy wake up. See as you crash for bed like say tomorrow no dey. Which kind sleep you dey sleep till this time?”, Matthew ask.
“Day don break?"
“Day never break for 6 o'clock? Bros J dey call you, he say make you come arrange money for breakfast. Abeg help me tell Nathaniel say na akamu me I go take chop my akara o, I no dey follow una chop bread."

"Bros J" na the name wey all the disciples dey call Jesus. Den dey call am Master sometimes too. Jesus don tell them before say dem dey go quick go Gadarenes that day. Na why Matthew gats wake am.

Nathaniel boil water cause na akamu almost everybody wan chop with the akara wey dem go buy. Na only John and Phillip talk say dem wan chop bread.
"Where John dey sef?" Nathaniel ask Andrew as him dey enter kitchen.
“Where him go dey before? No be Bros J chest be him pillow?"
“I go go tell Piro may he do roster for cooking for this house. How person go dey work here, John go sidon he no go do anything? Abeg go call am for me make he come help me mix this akamu."
"Abeg leave the guy, I go help you do am." Na so Andrew help Nathaniel mix the akamu and sharply the food ready.

After all of them ready finish, Andrew ask him brother, Peter if he fit call Charter bus make him come drop them for the Galilee Port where dem go take boat to Gardarenes.
"Call Charter? Say wetin happen? We go take our leg waka reach bus stop where we go enter public transport go Port. You no know say Jesus like to dey minister to people on the road as he dey waka? You know how many people go don dey wait us for road like so? Moreover, where the money wey you go take pay charter?" Peter reply.
"Piro, nawa for you o. I don ask Judas before I come meet you na, and he say we still get enough money. At least, make we sef dey flex sometimes, make we enjoy motor wey get AC. No wala, na wetin you talk we go do." Na so Andrew take end him talk with Peter.

...............

Sort:  

Dear friend, you do not appear to be following @wafrica. Follow @wafrica to get a valuable upvote on your quality post!

thanks..done!

@Popet, thank you for using the naijapidgin tag.

We encourage and support minnows.

Join us on discord: https://discord.gg/5SR8CH4 for more fun and to submit your posts for curation.

You like what we are doing and would like to support us? Join our trail here: https://steemauto.com/dash.php?i=15&id=1&user=naijapidgin

thank you!

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 62983.95
ETH 2962.52
USDT 1.00
SBD 3.58