The creed of life: npc episode 3

in #npc6 years ago

Anytime i enter steemit.com my mind dey always find @ogoowinner and the ogbenge next naija pidgin challenge wey she wan bring on-board. This one specially dey sweet me for belle like say i chop banga soup and starch. As we know, for this life.. we suppose dey guided by creed for everybody to live together as one for we world. Universal human right don declare am
Say where your right end na there another person right start.
I believe say everyone get their own right

I believe say all humans dey equal.

I believe say everybody no matter how dumb get reasonable something to offer

I believe say everybody dey special and unique.

I believe say everyone get beast and an angel wey dey inside of them. Like dem dey talk: one minute madness

I believe say everyone be the same.. no matter the skin color, religion, sexual orientation etc. If you be human you be human

I go do to you as i wan make you do to me.. so anything for this life wey go disturb or affect my neighbour. I no go do am

I no go allow fear stop me from wetin i wan achieve.

I go always be myself no be photocopy

I go believe say I fit make a difference if i determine

I believe say life no be competition. I go run my race.

I believe in peace.

I believe in charity.

I believe in forgiveness.

I believe in love.

I believe in mercy.

I believe say in justice na for all

I believe in human race.

I don make the decision to "live" no be just to "exist".
I, Buka Obiagha go abide by this creed all my days instasize_180129115224.png

Coin Marketplace

STEEM 0.26
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 61035.98
ETH 2886.89
USDT 1.00
SBD 3.67