My @dickiebash entry to The creed of life episode 3 @ogowinner

in #npc6 years ago

image
My people no dey look look down on your worth, no dey feel small by using anoda person glory compare your own ooo Becos sey the head wey your brother bring come dis life no be the same as your own, everyone dey special on their own, No dey set your goals on Wetin people see as important, na only you sabi what is best for you, no dey take things wey dey close to your heart for play, no let your future waste by living in the past, No give up when you still get sumtin to give, live your life one day at a time, be bolder always admit sey you no perfect, no shut love out of ya life thinking sey e no possible, the only way receive love sharp sharp na to give love,
A person without dreams equal to person wey no get hope at all and person wey no get hope na person without purpose
No run through life very fast

no think sey steemit na money ritual wey you just join and dey dey receive big pay sharp sharp
My people na one step at a time
No forget your heritage, this very vital
Life no be race but a journey you go dey savour with each step you take wether na forward or backward.. Take things easy and slowly
May Almighty God shower is infinite blessing on our dear @ogowinner
Still my humble self @dickiebash

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 64161.84
ETH 2950.76
USDT 1.00
SBD 3.60