(CREED OF LIFE) NAIJA PIDGIN CHALLENGE SEASON TIRI DON SHOW ooooo

in #npc6 years ago (edited)

FB_IMG_1517155301391.jpg
Na so we madam @ogoowinner take shele us better news say naija pidgin challenge 3 don hit we domot, nna, make me sef follow flex am small na...

Oyaaaaa how una de?

Today na Sunday, una been go church? Wetin Oga pastor been throway as message topic?? No tell me say u no sabi ooo, biko e de make sense make we de try for God too, the guy Man too try for us abeg, for seven days, as we bad reach, the boss go de prosper is, de protect we life, nna.... Him too try abeg.

Me like this I been go church ooo as I be Sunday school teacher for Redeemed Christian Church of we God, I been don de church since 7am, de try meditate and cabash small, make small inspiration for gree enter my small head, so as I finish am so, I go de teach, I been de teach on how we for take love God better.

So tomorrow now work don start again Abi? I no been tell una, I decided work for Federal High court here for Uyo Akwa ibom state, na so I decided take tell una say if una no show better love, na court we de go oooooo....

Haahahahahaahhaahhaa

@ogoowinner say make we put one Nigerian person pishure wey fine well well, as coret babe wey I be, me Don kukuma choose my crush #RMD ooooo
FB_IMG_1517154021287.jpg

Oya make I de jejely comot na...

I carry nyash for you ooo @ogoowinner
Weh done ma
More sbd fall on u...

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.11
JST 0.030
BTC 68621.95
ETH 3745.88
USDT 1.00
SBD 3.43