Camelions! wetin dem fit do you...na pigin contest by @ogoowinner

in #npc6 years ago

apapa, lagos
apapa.jpg
image source

e never too tey wey i join steemit. but e get one of my close friends wey we dey stay for desame room for hostel wey don dey on steemit befor me. everynite dis girl no dey sleep, she go dey use my system dem browse...so one day, i com ask her sey na why she no dey sleep; say wen people dey sleep for nite she dey press phone, wen pipo dey go class she go dey sleep. she sey na just chat she dey chat.

one dey na, one off our friends from uyo com PH, as we dey gist na...una no as talk dey lead to talk...na so dis friend wey visit com ask why me i no wan join steemit. me come ask her, wetin be steemit. she look me com look my roommate, sey wetin dey worri me. i tell her sey me no no wetin she dey talk kwa.

befor i sey anytin, my roommate sey mak we forget about d gist. so d next day, d friend wey visit us com dey tel me about steemit, how e don tak help she and my roommate. i almost cry dat day, say person wey me call my friend dey enjoy but she no wan mak me enjoy.

na dis one dem dem dey say "na person wey know peson dey kill peson!" my pipo, dis frenemy wey we dey talk about dem yakpa for steemit here too o...so use your head. no be evrybody wan mak e beta for you.

big sis @ogoowinner i bow for you!

Coin Marketplace

STEEM 0.30
TRX 0.12
JST 0.033
BTC 64512.59
ETH 3174.81
USDT 1.00
SBD 3.85