Naija Pidgin Challenge: Wetin Friendly Enemies Don Do Me

in #npc6 years ago

IMG_20180119_094252.jpgThat is an aerial view of the beautiful city of Port Harcourt.
images (5).jpgMy people, i don come with my own friendly enemies tori.
Dis tori been happen some years ago.
Naso I been dey for my room jeje and my guy Happy just call me say "guuuyy wear cloth wear cloth party dey this night and I hear say girls go full everywhere." I been no dey do anything so I come say "no wahala, which time?" Hin say "8pm". When 8:30 reach, we meet for junction take bike go d place.
As we enter d place, omo see babes full everywhere, naso we start to dey rock yansh upandan, having the time of our livesimages (4).jpg By d time 12 midnight reach, Happy come meet me tell me say make we dey commot go house, i come tell am say "guy calm down na d night is still young" he come say "guy just come make we dey go, i know wetin i dey talk". So I say a very hard goodbye and we commot. By d time we reach where we suppose take bike go house, naso 5 hefty boys corner us, before our brain boot, na slaps dem carry humble us. Them come carry our phones, cash, wristwatches, everything wey get valueimages.jpg I been think say e go end there, naso they carry us go atm make us withdraw all our money give themimages (1).jpg Chai we went home wailing.
Two days pass and I been dey pass Happy house, naso I see him dey talk to one of d boys wey rob usimages (3).jpg na den I come know sey d guy set me up.
Friendly enemies are confam the worst kind o, @ogoowinner talk am.

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.11
JST 0.030
BTC 69084.83
ETH 3770.66
USDT 1.00
SBD 3.52