The Creed of Life. I promise to live with this. #NPC CHALLENGE.

in #npc6 years ago

Thank God for our big sister @ogoowinner for making me enter another edition of Nigeria Pigin Contest. I pray say make baba God bless am and keep am.
This edition oo nah the CREED OF LIFE she say make we talk about oo.

THE CREED OF LIFE

I believe'am say everybody get right make people see'am, hear'am and love'am.

I believe'am say every human being dey equal.

I believe'am say de world fit accommodate everybody because say it big well well.

I believe'am say everybody get one thing wey he be baba for dis life.

I believe'am say everybody dey special and different

I believe'am say everybody get character wey bad like demon an get another wey good like angel. So I go make sure say I kill the one wey bad an show people the good side.

I believe'am say people body color, religion and level wey dem dey for society no be anything, na just wetin men wey dey sellfish dey use control odas, cause wahala and make people think say them be oga . nah why i accept say make I be human being first oo before i come dey call my people, religion or level.

I go dey treat people dey way I go like make dem treat me.

I no go follow people dey yarn becus of wetin dem be but becus of wetin I wan make dem be.

I no go follow do business or anything wey go cause wahala to give people.

I go try make sure say I no judge people, but na understand dem.

I no go allow envy, jealousi an greed control wetin I dey do.

I go make sure say as I don come dis world I go do one beta thing wey go helep everybody before I go comot for dis world.

I go make sure say I dey strong even wen things dey good an wen e no dey good.

I no go allow fear make e hold me.

I no go allow anything wey dey bad come dey my mind, I go make sure say anytime wey bad thing wan enter my mind, I go replace'am with good one immediately, becus I no say something wey dey person mind get power oo.

I go be me, an no go copy people anybody.

I no say I go do beta if I hustle wel wel for any work wey I dey do.

I no say dis life na jeje, no be fight, so I no go follow anybody fight becus say life nah jeje

I believe in peace.

I believe in helep

I believe forgiveness

I believe in love

I believe in mercy

I believe in justice for everybody

I believe in people

I don decide say I go live no be to just dey exist.

Me wey be @Godswill go follow dis creed till dye day wey I go comot for dis life.

I also believe'am say

I go dey help people wey need help an no do anything wey go make person cry.

I no go do anything wet go make people wey dey around me reject me.

I go dey do give everi body as i go like make dem do unto me.

Thanks for reading;

Still on Nigeria Pidgin challenge, picture wey I put na for pine forest, Independence Layout Enugu

Sort:  

This one Na real correct yarns.. You do well my brother

Thank You brother

Mr Godswill well done for this one wey you drop o

Make my God contnue dey bless you wela

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 61293.86
ETH 2930.90
USDT 1.00
SBD 3.65