CREED OF LIFE NPC; EPISODE 3...

in #npc6 years ago

Fellow steemians, I dey hail una! This na obonge episode 3 of Naija pidgin challenge wey @ogoowinner don arrange for us soIMG_20171212_183203_837.jpg

I believe say both man or woman get right make them for see them, hear them and kuku love them.

I believe say every human dey equal.

I believe say the world dey big reach to contain both man and woman

I believe say both man and woman be boss for at least one part of them life.

I believe say both man and woman dey special and unique.

I believe say both man and woman get both beast and angel inside them. So I go try my best try suppress beast go down make the angel for fit rise show imself

I believe say where u from, where u dey worship and social status no matter, na just all those things wey some kind men them create to for fit they control other people,dey cause strife (katakata) and go come put inside people that oga mentality. So I don choose say to be "human being first" before I go rep any race, religion or class ...shikina

I go treat people the way I want make them treat me

I no go come dey react to people based on who them be, but who I want make them be.

I no go put hand for any business or project way go cause people harm.

I go try understand people no be to go become judge for where them dey.

I no go allow envy, jealousy and greed control my reason to do sontin

I go try do at least one notable thing for humanity before I bounce from this earth.

I go try my best to dey strong for the face for where them misfortune, grieves and sorrow dey

I no go allow fear make e form come intimidate me.

I no go allow all them negative thinking so full my mind; I go replace am sharpaly with peaceful and creative thoughts as soon as them come up because I know say "thoughts really dey powerful".

I go always be who I be, my real self and no be photocopy of another persin

I believe say I go fit make things dey another way if I go fit put in my best for any task them give me

I believe say life na journey no be race, so I no go allow my self to go dey hustle careless with anybody

I believe for peace

I believe for charity

I believe for forgiveness

I believe for love

I believe for mercy

I believe for justice for everybody

I believe for human race

I don decide to dey live no be to just dey

I don decide say I go change some kind things for this world before I bounce.

I Omeludike kossy go abide by all the things throughout my lifeIMG_20180128_113554_643.jpg

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 66304.34
ETH 2983.64
USDT 1.00
SBD 3.68