My Own Ogbonge Creed!.... Entry to NPC Contest.

in #npc6 years ago

Una well done oo! I greet all of una. This na my own ogbonge creed wen i don decide to dey follow. This na my own little hustle to better my life and to better the life of any correct peraon wen go try read am. Abeg make una read am and help me put mouth for the matter.

I believe say everybody get right to see an be heard and loved.

i believe say all human being dey equal.

I believe say this world dey big enough to contain everybody well well.

I know say everybody be correct oga for at least one area for life.

I know say everybody dey special and unique.

I know say everybody get beast and angel for inside them. So i go try all my best to hold the beast come arouse the angel.

I know say race,religion and social status dey nothing but creation of all this nonsense men make them dey use control other pipu,dey cause quanta for pipu. So i con choose to be "human first" before i follow for any race,religion or class.

i go treat pipu as i go like them treat me.

I no go react to pipu based on who they are,but who i go want them to become.

I no go partake for any business or project wey go cause harm to another person.

I go strive to understand pipu and no go Judge them.

I no go allow envy,jealousy nd greed to control my motives.

I go accomplish at least one good thing for human before i commot for this earth.

I go try remain strong for the face of misfortune,grieves and sorrows.

I no go allow fear do me anyhow.

I no allow negative thinking occupy my mind; I go replace my mind with peaceful and creative thoughts sharp sharp because i know say thoughts dey powerful.

I go always dey me,my real sef and no photocopy of another.

I know i fit make a difference of o pit all my best for any given task.

I know say life na journey and no be race,so i no go permit me to go to any competition with anybody.

I believe for peace.

I believe for charity.

I believe to forgive.

I believe in love.

I believe in justice for everybody.

I believe in human race.

I make the decision to live. I go make sure i dey show myself well well.

Abeg my people, i thank una well well as una don follow me read this my ogbonge creed.

20180129_163746.png

Image source

This picture na one of the top ogbonge actress when dey our correct country naija. Her name na Omotola Jalade Ekehinde.

Make all of us continue to try our best to make our country better. Una welldone oh 👐

Sort:  

thanks for sharing

Congratulations @melanie00! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of upvotes

Click on the badge to view your Board of Honor.
If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

Do not miss the last post from @steemitboard!


Participate in the SteemitBoard World Cup Contest!
Collect World Cup badges and win free SBD
Support the Gold Sponsors of the contest: @good-karma and @lukestokes


Do you like SteemitBoard's project? Then Vote for its witness and get one more award!

Coin Marketplace

STEEM 0.26
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 61035.98
ETH 2886.89
USDT 1.00
SBD 3.67