NPC..MY OPINION ON THE KILLINGS 4 WE COUNTRY.

in #npc6 years ago

Omo, thank you my guy @josediccus and @ogoowinner 4 choosing dis topic. Although we don talk tire concerning dis matter yet notin don happen bt d fact be say if we lock up our mouth notin go still happen & e go mke d government even more relaxed sef. So mke we continue to dey yarn abt dis matter every where until d government do something.

Nah only 4 nigeria nah ein cows get more privilledges pass human being. Nah only 4 Nigeria nah ein fulani herdsmen go kill about 200 people yet the president go keep quiet about the whole matter. This issues just show how much our president care about national unity, him allow all this tin to dey happen just because  the fulani herdsmen nah him people. If them say those herdsmen nah foreigners then e mean say nah foreigner be the Nigerian president right now. 

The president don prove beyond all logical doubt say him dey biased on this issue. Una remember wey sompeople been retaliate come kill some of those herdsmen, the president deploy soldiers to benue immediately to protect him cows. B4 nah still dat same man wey say nah police issue oo, bt as cows nd herdsmen don dey die nah ein e become military issue.

But no be just the president nah im i dey vex for. Wetin our useless senate don do concerning this matter?? The so called highest paid senators in the world never even consider to pass any bill wey go resolve this whole issue. So that the president nor go get any excuses not to act again, because recently him be they talk say him nor get the constitutional right to form cattle colonies wey for stop or atleast minimize this killings. But if nah to carry out operation python dance to kill people wey dey protest for their rights for east him nor go need constitutional backings. I come dey wonder wen forming of cattle colonies require constitutional right nor be to do am as a project 4 those herdsmen ? But since constitution don come inside the matter, wetin our useless senate dey do about the matter? Nothing.

My peopel i fit carry vex talk about this issue all day. But nah something we all dey aware of. However, nah beg i dey beg alll of us to try dey safe. Human life nor get duplicate oo, make we make all necessary effort to protect  ourself because life dey very important. Since the government don abandon us make we nor abandon our self.

Nah on this note i dey also take dey beg state governors make dem nor behave like benue state gorvernor wey dey cry up and down. But make dem try protect the people of their state cause security within their state nah dia responsibility too. If nah to form vigilantil group wey go dey armed with gun against those herdsmen abeg make them try do am because  human life dey very important. We nor go fit siddon dey wait for the president while people dey die finish for we country.

Me i from rivers state oo, and mke i hear say those mumu herdmen miss road near our state. Infact dem nor go even fit try am because nah die dem go die finish and that their cows  we nor go kill them. Nah chop we go chop dem.

My people nah so this matter boil me for mind oo. Abeg make we all try dey safe.

Sort:  

Congratulations @ngbarabe! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of comments

Click on any badge to view your own Board of Honor on SteemitBoard.
For more information about SteemitBoard, click here

If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

By upvoting this notification, you can help all Steemit users. Learn how here!

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 62441.36
ETH 2940.53
USDT 1.00
SBD 3.59