NPC ... WE NEED THAT DELETE AND BLOCK BUTTOM

in #npc6 years ago

Kai! So person get mind call our big madam @ogoowinner scam! I just they hear the gist now and e nor sweet me for belle at all. 

Me on my own been don reason about that delete button long time ago ooo, and as @ogoowinner talk am nah for replies to our post wey e dey most important. Nah so one day i siddon write better post about the politics wey dey happen for we country. Base on how i like the post i been nor even care about the upvote at all. I bin just want make the post dey interactive. 3hrs pass no body comment on the post, nah im i say make i go do other things naa as i return to my blog on steemit after about 1hr i come see like 13 comment. With speed nah im i tke open the post to see the comments. but wetin i see nearly wan make me cry. One guy like that wey him reputation nah 25 don send me about 8 messages like that say make i come join group wey him create for minnows, no be bad thing the guy do oo but to send the message 8 times on one post haba! E too much naa

Those him message just spoil my post like that and better people nor fit comment again on the post wey i write.

Una know say if that delete button been dey i for just remove those him comment to save my post.

Also no be every body like us for this world. If dem been hate Jesus wey been dey perfect then our own nah small matter, nah base on this fact wey the block button suppose dey too. Cause somepeople nor like us and even if we spend 1 year dey compose one post dem go read am  still condemn am and comment rubbish to cause scatter scatter and quarell. Nah im make when we notice such people the block button suppose dey for us to apply am on them forever.

Aunty @ogoowinner no vex for that bros abeg, the guy just escape from psychiatric hospital. All of us know say you be better person.

Thank you for bringing back NPC

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.11
JST 0.030
BTC 71342.73
ETH 3809.46
USDT 1.00
SBD 3.49