NPC Friendly Enemies: Na im be the new yawa for ground

in #npc6 years ago (edited)

My country people, I hail o! Aunty @ogoowinner you dey try well well. You know say no be everybody fit yan better English. Nwannem this npc go well, I ghotago?

Na friendly enemy tori we dey abi? Make I yan una. Na so one day, me and my people just dey gist better gist. You know say as woman, amebo suppose dey your blood. From man talk o, na so we enter woman matter. Person wey get better aka gum come become topic of discussion. We just dey talk dey laugh dey go. Everybody get wetin im talk for that matter.

IMG_20180126_160013.png

My brothers and sisters, I no know say no be all of us fit code for dia o! If dem tell you say person just balance im sef dey record everything wey we been dey talk dey put am for im mind, you go believe? The thing shock me o! The next day never even break finish, another person come dey talk...and I trusted you...this one pain me die, I swear, but I just lock up.

So my people, Oyinbo don talk say, 'the walls have ears'. No carry better gist give person wey im mouth no fit dey one place. Make una dey careful o! Before you carry pant wey you never wash go hang am for backyard. Tankio.

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 62668.08
ETH 2908.37
USDT 1.00
SBD 3.58