My Steemit Naija Tori

in #npc6 years ago (edited)

See me dey shine my teeth as I dey reason to troway my own entry

Where I for start?

The kind thing wey worry me before i land gidigba for here ehn no be tori wey I go fit share for one day if I begin dey pour the thing comot. I thank God for @tojukaka wey show @phait this way, wey come show me the real matter wey steemit been dey about.

Tor, Wetin Steemit don do me?

My business waka bin dey get some kind gbege when I enter this place. The things wey dey happen then been shake me ooo. I do thatt thing wey we dey call introductory post, as the mater con end with some kind change wey eventually bail me comot for that yeye mess wey i put myself oo.That one thing, I no go fit forget till Master Jesus show this world oo.

You see the kind life wey i dey live now, na that kind life wey person wey dem born for palace dey live now, because anytime e remain small make I give up, I just remember steemit and wetin e don do me, I just dey happy say I enter this level when dem been tell me.

As E con be now

Person wey look you say you hungry, come give you food, you go sabi say him go give you more when the time enter na. The kind knowledge wey i don swallow for here na baba ooo. People just dey post different things wey don dey very helpful to me and I dey grateful to Steemit for that one oo. Maka why? Na so the tori just end.

@ogoowinner, take this small kiss and hug, chop am, you deserve am. I love you plenty.

Thank you well well for this quarrel matter, abi na contest matr wey we dey.

IMG_20171206_094643-1.jpg

Coin Marketplace

STEEM 0.29
TRX 0.12
JST 0.033
BTC 70272.86
ETH 3773.70
USDT 1.00
SBD 3.82