How my bestfriend almost kill me becoz sey i no date am, pigin contest by @ogoowinner (TRUE LIFE STORY)

in #npc6 years ago

calabar town
calabar.jpg
photo credit

dis one hapen wen i dey skul for manchester. i get one guy padi like dat wey we dey always do tins togeda. dis guy dey frequent my crib and mesef dey go him haus. on day like dat, i been dey com baack from skul wen e don dark, na so som guy wit mask for dia face begin comot fro no where block me.

one point gun sey if i shout, sey him go blow me shot. wit fear na, i just sleep for ground begin dey panic. as i dey beg dem one of dem sey mak dem shoot me sharp sharp befor e tey, as d guy dey comot him gun, one of dem sey mak him leave me sey i too fine and innocent to die for wetin i no do.

befor i know, dem begin argue among dem sef, two sey as dem don colect moni sey dem nid to finish dia job, but one particula guy sey him dey pity me. sey mak dem free me. na so God tek epp me dat nite.

d next monin, d guy wey sey mak dem no kill me, jam me for skul tell me sey na d guy wey me dey folow roll na him send dem on dat movement last nite. sey mak i dey careful or if i fit mak i leave dat town go skul for anoda place. him even tell me sey na becoz sey d guy don ask me out several times but me no gree, na him mak am wan hurt me.

Na from dis tin wey hapen , pale come sey mak i com back naija befor one oyinbo fuckboy go end my life for me.

Coin Marketplace

STEEM 0.29
TRX 0.12
JST 0.032
BTC 62989.29
ETH 3048.32
USDT 1.00
SBD 3.99