nigerian pigin challenge

in #npc6 years ago

I believe say everybody get the right to be seen, heard and loved.
I believe say all human beings dey eqaul.
I believe say the world dey big enough to accommodate all of us.
I believe say everybody say e get that one thing wey each person sabi do.
I believe say everybody dey different from each other in one unique way or the other.
I believe say everybody get in own beast and angel wey dey inside am, so na to keep the beast on the low and try dey
show that angel part.
I believe say race, religion and social status na nothing but the creation of kata kata men to use control others,na in dey cause strife the in-plant supremacy mentality. so me i choose to be "human first" before i fit be any race or religion or class.
I go do people wey thing me i go like make them do for me.
I no go relate with people based on who them be but based on wey thing i want make them become
I no go do business wey go bring problem for another man.
I go try understand people instead of to judge them.
I no go allow envy, jealousy and envy to control my motives.
I go make sure say i achieve one better thing for humanity before i commot for this earth.
I go try dey strong even for the face of misfortune, grieves and sorrows.
I no go allow fear intimidate me.
I no go allow any negative thought get space for my mind, i go replace am sharp sharp with peace and creative thoughts as soon as them come because i know say thoughts get power.
I go always dey my original self and not to photocopy another person.
I believe say i fit make difference if i put in my best to any given task.
Iibu-320x220.png believe say life na journey instead of race, i no go allow myself go into competition with anybody.
I believe in peace
I believe in charity
I believe in forgiveness
I believe in love
I believe in mercy
I believe in justice for all
I believe in human race
I make the decision to "live" and no be to merely "exist"
I Sir.steve go abide by this creed all the day of my life.

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.11
JST 0.030
BTC 71152.89
ETH 3805.51
USDT 1.00
SBD 3.49