Nigerian pidgin contest:episode 2

in #npc6 years ago

Dis life dey do pesin strong thing o, but all dis yeye pesin dem wey plenti for dis life wey suppose be Awa paddi dem,wey suppose helep us small as we dey helep them so, we go reduce the wahala of life small small, also dey rock life small small as baba God plan for us so, but no now many of dem don decide to put sand sand for Awa garri, come make life hard us even plenti pass as e suppose dey, dis pesin dem go pose for your front like sey na dem beta pass and like sey na dem gud pass, meanwhile for your back na dem go dey spoil your market small small,dis people nain oyibo people dem call "friendly enemies"....i thank @ogoowinner as she bring dis contest come awa dormot say make we yarn awa own for the Mata, com still see way win small something. @ogoowinner you don do well o
Na this matter now, me I wan yarn about, dis thing wey bin happen to me e pain me o no be small, I no believe sey my paddi go do me like that so, but e happen to me, na so I see am with my korokoro eye, this my paddi (make we call am Ms L)...me and Ms L bin close o well well if you see us that time you go think dey na d same Mama and papa born us like this,We bin dey share things den o,personal mata(na here my problem start)....if I tell am things based on sey she be my friend ..she go carry the tori go yarn another pesin even add shuga and salt,make e for sweet well well...na so I go dey, dey hear my matter with anoda pesin, something wey I tell my paddi for one side o..and she go come my front come dey smile to hear another thing, NA SO me I close my door, Comot body for her mata, abeg I no dey train newscaster for my side. Abeg me una shine Una eyes wella, today na gist, tommorrow e fit pass dat one
E go be , na Comot I dey so.

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 65229.52
ETH 2946.17
USDT 1.00
SBD 3.67