NPC; Block button needed

in #npc6 years ago

I don join as e dey hot, i thank my boss madam @ogoowinner for this ogbenga matter wey she carry put ground now.

You sabi why i come love facebook, na because say person get em own privacy, i go choose person wey i wan chat with, i go choose person wey go dey see my post so i no go dey entertain all this people wey sabi vex person with thier comment for your post.

20180208_104951.png
[Alex iwobi]

E get one day wey i just dey roam around for my steemit feed, just to find beta post i go come comment for. Omo if you see wetin i come see for the comments eh, e dey like say i dey experience second world war, the kind thing come tire me.

Abeg we need move this to another level make all our oyibo bosses see wetin we dey go through for here. BLOCK BUTTON NEEDED we need am well well, in fact we need am ASAP

Me i don talk my mind o. I wan use this medium thank our good hearted madam @ogoowinner for all the good things wey she dey do, your boy is always loyal @uniquegem ma

Sort:  

Good one, will try mine

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 60918.56
ETH 2919.11
USDT 1.00
SBD 3.56