Wetin friendly enemies don do me. Thanks to @ogoowinner for this opportunity.

in #npc6 years ago

Thank God for @ogoowinner for this contest wey she make me get opportunity to enter. Twale.

Wetin bad friends don do me oo. I no fit talk all of them but make i talk one.

download (15).jpg
Federal Government College Nise, Anambra state, Nigeria

Nah when i finish secondary school this one take happen.
My papa promise me say if my weac dey good he go carry me go away do my university.

I no sleep at all when i dey prepare for my weac. Finally i make am. 6As and 3Bs

I go tell all my padi. All man dey rejoice with me even Chika wey be my girlfriend. She say make i come see am for house make we celebrate.

As i come dat day her papa no dey. She say make we stay for her room yarn. When we enter she beg me make i no go abroad say she go miss me.

She cry sote i promise am say i go dey come back come see am.

When i wan commot she come kiss me. And i never do am before oo.

My body come dey hot sotey i no fit resist her body. We continue until we comot our clothes.. you know wetin come happen

Chika papa come knock for my door one day, say him daughter say i make am pregnant. I no fit deny am oo.

Dey force me make i marry Chika but i refuse am say i go travel go abroad and i never dey ready. Him papa refuse say i must marry am.

Embassy come call me next day say make i come. I reach there see Chika father, he tell them say i get son for Nigeria and i wan run commot go abroad. I beg dey sote but they no belive me.

So nah like this i miss my chance to travel go rid abroad..

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.12
JST 0.032
BTC 67674.48
ETH 3755.42
USDT 1.00
SBD 3.72