PIDGIN CONTEST: CREED OF LIFE. 3rd Episode

in #npc6 years ago

PicsArt_01-30-03.12.52.jpg
Credit google

I'm still very new here and someone told me about this yesterday. I heard that @ogoowinner has been organizing all these wonderful contest. Thanks to her. I decided to try out my hands on it.

I believe say all man get the right make other people sabi them hear wetin them get to talk and love them

I believe say all man na the same

I believe say this world boku so tey it fit contain all man

i believe say all man get the good wey normal person no go fit challenge them

i believe say all man dey stand out from another

i believe say all man or get the bad belle side and the beta side for their body so, me i go try my best starve my karashika and hail my angel

i believe say your race, who you dey kneel down to every morning, or the level where your village people dey put you no mean anything them just be wetin man dey use control another man, cause wahala and make pesin reson say he pass another person, but me i go respect human being frist before i go reson all those ones

i go dey do people as i want make them dey do me

i no go dey relate with people based on who them be, but based on who i for like make them be

i no go chook leg for anything wey go dabaru another pesin

i go try my best make i dey reson wetin person dey do no be just to judge them one hand

i no go let bad belle direct wetin i wan do

i go do one better thing for humanity before i kpai

i go still get my strong bodie.. even when so so misfurtune dey find me

i no go let fear hold me from doing wetin i wan do

i no go let bad belle last long for my head, i go quickly replace am with jolificating things

i go always be original bobo.. i no go try be another pesin

i sabi say i fit change something so i go always give my best

i believe say this life na journey, everybody get where them they go, no besay we dey rush go the same end point, so i no go dey compete with anybody

i believe in peace.. e no get how else i wan talk am

i believe say if i get i suppose give those wey no get the leanest

i believe say i suppose dey allow person wey don jonze me go free

i believe in yori yori and parti parti

i believe say wetin dey good for papa also dey good for mama

i believe in our hustle becos e go pay

i don decide say i no go just dey , but i go experience everything for life so they I go make better impact

My name na @youngfred and na by this creed I go dey live.
Oya make una follow me declare too becos na better thing.

@ogoowinner
Picture wey dey for up na omotola aka omosexy

Sort:  

Welcome to Steem. Do read A thumb rule for steemit minnows - 50:100:200:25 for starter tips.
Also get to know more about Steem reading the Steem Blue Paper and share your feedback on our Steem Blue Paper Awareness Initiative
All the Best!!!

Welcome to Steemit. I think you will like it. There are plenty of people who love talking about cryptocurrencies, but lots of other interests too. Have fun

Coin Marketplace

STEEM 0.24
TRX 0.12
JST 0.030
BTC 69560.97
ETH 3671.57
USDT 1.00
SBD 3.29