Story book 1

in #poetry6 years ago

Story Book

The tin wey I see that mawnin nor be real
My heart still they wonder wetin e be
Person still dey wey fit fine like this
Like wetin dem pluck comot for sea.

As she dey waka wen she turn look me
My liver fail me, my heart cum dey run
So tey I nor knw wetin to talk,
Wen she ask me "How you dey?"

The word wey comot my mouth nor get meaning
The way I dey shake u nid to see me
Fine baby like this know my name
Mata change wey she say she love me

Dis kind love dey only dey story book
Hw she go love me with this my look
Na lie na mami water wey na me she cum hook
So I tear race, till I tire like dodo wey dey cookstorybook1.jpg

Sort:  

This post has received a 0.23 % upvote from @drotto thanks to: @steemnaija.

This post has received a 0.64 % upvote from @morwhale thanks to: @steemnaija.

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.12
JST 0.033
BTC 69488.13
ETH 3501.35
USDT 1.00
SBD 3.69