7 secret wey new persin go use take make beta money for steemit.

in #steemnaija6 years ago

Na everyday n aim new new pipul dey join steemit, n aim mk I say mk I tell una secret wey una go fit take make beta money from steemit. Immediately many pipul join steemit dem nor dey know wetin to do at all, dis secret wey I wann tell una go help una knw how una go waka for inside steemit. Oya make we start

  1. Dey do new new post instead of dey upvote pass, many pipul think say na to they vote for steemit whales them post na im go mk dem quick get money, Na LIE, though you go fit make money but d money nor go reach anything because your steem power go too dey low, so instead of dey go take your tym vote pipul post dey use that time create beta beta post dem.
  2. Nor lazy, wen we dey talk of beta post for steemit nor b to just carry anyhow pictures or wetin dey make persin laff wey u see for anoda social media group cum post there, u need to take tym dey prepare your own post, make different from wetin pipul don put before and mk him fyn well well
  3. Dey comment beta comment for pipul post, nor be to just go there go write “Nice One”, talk beta thing there, you fit also get small money from dat one
  4. When you wan post, they use pictures for your post, nor be anyhw picture oo, but picture wey relate to wetin you dey talk and wey fyn well well wen pipul see am dey go like am
  5. Make you dey post everyday, nor let one day pass without you nor post sumtin, infact if you get the tym dey post more than 1 post in a day, he go help pipul sabi you well well, and if your post dey make sense he go dey mk dem cum dey check your feed every day to see weda new thing don cum
  6. Take time dey plan your post, once many many idea enter your head anywia you dey just dey write dem down, den when you don relax, settle down write you post, read am over and over again, correct every mistake before d time wey you go post am reach.
  7. The last one name steem power, for my last post I discuss about wetin steem power be, if you go read that post you go see am, so if you don dey gather steem power nor rush go sell your steem power take make money, keep am, instead of say make you sell am leave am there so that you go dey get more more money wen you post and when you comment for pipul post

    Na the secret wey I say make I tell una b dis, if una fit follow am he go help una grow quick quick for steemit, and if una need any help just go click on the link for my bio to join SteemNaija whatsapp group.
Sort:  

This one make sense wella

You have spoken well...most people thinks steemit is just post and earn.of you understand It will you will know How hard it is.especially to sit down and make a very good post.so lets try and obey those 7 rules and you will be Smiling to the bank

Nice and helpful tips, I like the language too.

Nice one. Good yan for our brain. You too much

You have said it all, steemit can take one to the next level, thanks.

Congratulations! This post has been upvoted from the communal account, @minnowsupport, by steemnaija from the Minnow Support Project. It's a witness project run by aggroed, ausbitbank, teamsteem, theprophet0, someguy123, neoxian, followbtcnews, and netuoso. The goal is to help Steemit grow by supporting Minnows. Please find us at the Peace, Abundance, and Liberty Network (PALnet) Discord Channel. It's a completely public and open space to all members of the Steemit community who voluntarily choose to be there.

If you would like to delegate to the Minnow Support Project you can do so by clicking on the following links: 50SP, 100SP, 250SP, 500SP, 1000SP, 5000SP.
Be sure to leave at least 50SP undelegated on your account.

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.12
JST 0.033
BTC 66996.44
ETH 3098.15
USDT 1.00
SBD 3.72