How you go fit tk make am quick quick for steemit

in #steemnaija6 years ago

Una well done o, all my people wey dey for steemit, especially nigerians wey newly enter steemit, I wan tell una about sumtin wey dey steemit wey go mk una get money quick quick for steemit.

If you luk your steemit username you go see am say after the username e get one number wey them dey write follow the username sumtin like this “SteemNaija (25)”. You see that 25 so? Na im be everything for steemit.

Dem they call that number “STEEM POWER”, and e dey very important say that number increase, y bcuz na that number na im u go tk dey get plenty money if you post sumtin put for steemit, if you upvote sumtin or if you even talk put for anoda person post.

Make I explain am well, you don eva check sum post you go see say 200 person na him upvote the post and anoda post na 300 person upvote am but when u check the money wey dem get, the 200person own high pass the 300 person own, y e b so? Na because of steem power.

For steemit people wey get high steem power dem dey call dem “steem whale” e beta mk 5 steem whale vote you than for 10 new new steemains to vote you, and when u be steem whale na so ppl go dey follow follow you anyhw like flies wey dey follow shit.

So how we go take get this Steem Power?

  1. Make you they post beta beta thing for steemit nor be anyhow nonsense ooo, things wey people go like, and when you they upvote or talk for another person post, make e be beta post o, nor b say person go carry anyhow thing put there you go cum go vote am.

  2. The second way na to carry the steem or steem dollar wey you get tk do power up (if you do am e go help you well well)

  3. If you get computer you fit do wetin Oyibo dey call mining for dat one dem go they dash you steem power for say dem they use ya computer they check steem if you wan do that one go check this page. https://steemit.com/steemit/@cryptos/getting-started-mining-steem-on-windows

So my fellow steemians make una do well to make sure una power up ooo, cuz na the koko b dat and steemnaija dey here to help una anytym at all, all you need do na to join our steemnaija chat group on whatsapp https://chat.whatsapp.com/Gww9dOEw7oiHlHHpXBRult

WhatsApp Image 2018-01-31 at 11.04.47 PM.jpeg

Sort:  

Steem was created to bring great content to everyone. Thank you for fulfilling the prophecy

na so we wan dey do am, thank you say you carry eye see us

Upvoted...true talk...

There is another way wen persin go fit still make steem power, that is converting all your earning to steem power, for the bottom wen u dey write post u go see wia dem say 50%/50% that one mean say ur earnings them divide am between steem power and steem dollar, but u can decide to make am only steem power, by changing dat thing to 100% power, so all ur earning go b for power up

sir pls be using pure ENGLISH sir

sorry i dont know you chose pigin

Hope say Nigerian pidgin nor dey hard for you to dey understand?

Thanks for the word.

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.12
JST 0.032
BTC 65955.88
ETH 3055.54
USDT 1.00
SBD 3.69