Na Life Be this o!!!!

in #wafrica6 years ago

stock-photo-closeup-portrait-of-sneaky-sly-scheming-young-woman-plotting-something-isolated-on-gray-363602234.jpg
Antonia say na holy girl
But person husband na she Dey call dear

She Dey form virgin Mary
But her body be like MTN share
Sis. Sonia say 'I be choir director'
But she snatch her best friend guy

Her new room mate nor fit trust her
Becos everybody story she Don hear

Sarah dey sabi condemn person
And bad tinx na her tight padde

She carry church for head
but I shock say she still dey chop yahoo bread

Sis. Moha introduce Sarah to her lover
Sarah pass back to collect d guy phone number

UNJ
You need Jesus

Bro. Samuel dey give me relationship advice
but he almost rape Mary
Abba!

He dey condemn sinful act
But for night he join ogboni cat

He leg nor Dey comot for church
but he friend fiancee na he won burst

As he hear e friend foot step
he fly widow, he cun Dey dodge

I nor Dey do holy than thou
But he righteousness na filthy gown

UNJ
You need Jesus

Early morning, Bro. George dey shout ''Preach''
But Dey catch am wen he comot landlord wife pant

Olowo Tel e brother say God na Dey bless
But he spend 50k one night for olosho club press

Fellowship leader say sinners go end for hell
But becos of money, he sleep for cell

Aunty Grace say ''abortion na sin''
But abortion Don turn her pikin

I still dey wonder
If she nor ready to buy napkin
Why she cun Dey lie say na rehearsal time

Wen d song Wen she dey learn
Na d shout Wen she dey ontop Choir master bed

UNJ
You need Jesus

Pastor Dey use stick of mop tak beat e wife
Becos she say children Neva chop

He nor go drop money for soup
But ontop Nkechi home cell, he Dey spend ontop

Bro. Moses na e sow seed pass
But he children still dey manage one slippers

Mr. Tobe agree for Altar say ''for better, for worst''

but Wen wahala burst
He run go Lagos go lost

Maria say na by God's grace, she dey pass
But to teacher office, she get secret pass

Sister Gladys say Egera na her Christian sisters
But secretly, dey der see stars

Dey preach say fornication na sin
But two of dem Dey touch Deir pussycat tin

UNJ
You need Jesus

Sylvester thief Kingsley facebook post
He cun Dey form Mr. host

He facebook timeline na crime scene
No wonder, he brain equal nothing

Revd say God is faithful
But he dey very unfaithful

Like small pikin
He Dey cheat waka

Tony say ''in God we trust ''
But Amadi ass na he won burst

UNJ
You need Jesus

Adam tell Tina
''God say she go be he wife''
Just to use e bros cut her like kitchen knife

He cun Dey claim say she go give am staphy
Base on say he don straph her

I nor Dey curse anybody
I just Dey beg us, mak we nor form wetin we nor be be

Make we nor dey use Bible cover face
Cun Dey abuse God solid grace

UNJ
You need Jesus

®AkposDking

Thanks for reading

Still @emmaxx

Sort:  

@Emmaxx, thank you for using the naijapidgin tag.

We encourage and support minnows.

Join us on discord: https://discord.gg/5SR8CH4 for more fun and to submit your posts for curation.

You like what we are doing and would like to support us? Join our trail here: https://steemauto.com/dash.php?i=15&id=1&user=naijapidgin


Sponsored by @ogoowinner

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 61372.42
ETH 2928.56
USDT 1.00
SBD 3.66