.

in #writing6 years ago

![ogamat.jpg](

EPISODE ONE- I Don Change Base

Any time wey rain fall for Lagos, di ting dey make me laugh. Even dough rain dey try to spoil business for me wey dey always dey for road, but wetin man pikin fit do for di ting wey God don sign? Rain must to fall if we must 1ww ! If road flood wen rain dey fall sote man no fit put im taxi for road, dat one no be God fault. Na all dose gofment agbero dem cause am. Dose people wey dia work na to take dia pen do amu robber for gofment office. Road wey don spoil finish, dem go write am for file for office say dem don turn am to expressway - all to take blow di peoples money. Well, God dey
But bad road or no bad road, flood or no flood, I dey always like di orisirisi tings wey dey happen wen rain fall. Una kukuma sabi say na sisi dem dey like to carry umbrella pass. If small water just drop kpere from di sky, you go see Lagos bobo dem for action. Dem go hang for one corner, dey target any sisi wey go just open umbrella. Na dat time you go see say one bobo go just rush like hawk wey see chicken. E go take style beg di sisi make e let am share di umbrella reach somewia for front. Na so di two both of them go manage di small tiny umbrella. From dia, body go touch body, and from dia ••• (na you sabi)
Di order day na so I siddon for our garage dey look road wen rain dey fall. I no gree put my guonguoro for road make flood no swallow am for me. Na so I just dey look as bobo dem dey rush dem sisi wey carry umbrella. I shake my head, den come talk am for my mind say na wa for Lagos o! Small time di rain stop, cold come catch me no be small. Na im I say make I go under bridge go buy small hot, take warm my body small( na just because of di cold I take am, dat's why I no call am ogogoro. Na agbero dem dey shack ogogoro, orderwise known as gbaraga)
But wen I reach under di bridge, Iya Sale no come market, na im I say make I touch railway go see Iya Afis. Na only dis two madam dia hot be original. If you pour dia hot for ground, and strike matches put, e go catch fire one time. Di rest na fake.
So, I take like two shot for Iya Afis hand. As I begin dey go back to garage, na im rain start again. One sisi like dat hold umbrella dey come for my back. Wen di sisi see say di rain don dey soak me, e say make I join am for im umbrella. But DAT one no make di rain stop to beat me becos di umbrella just big small pass cocoa yam leaf. Di only ting be say I enjoy di ride no be small. Na so di sisi just take im ripe pawpaw wey dey im chest, dey rub my body. If I do like say I wan dress small, di sisi go come near me bumper to bumper. But make I talk true, I no know who dey come close, weda na mi or na di sisi. But wetin I know be say, di sisi pawpaw wey stand paparapa like Standard Bank, just gum for my body. Chaaii! All di cold wey dey catch me before, just disappear! To waka well self hard me. My two leg come begin dey shake for ground like Shakespeare. Tori Olorun! Na dat time I come sabi di kind enjoy wey dey for inside dis rain and umbrella business. No wonder!
Small time, di sisi ask me weda I know wia Ikeja taxi garage dey. I tell am say na dia I dey go. I ask am who im dey look for. Di sisi open im handbag, bring out one letter. I see dem write for di envelop, "To Oga MAT." I tell di sisi say na my letter. Wen we reach Ikeja under bridge, we stop. I open di letter read am. I see say na my main man, Sunny Okim, write me. E say im don change base. E say now im dey for inside dis Steemit. I happy for am no be small. Who no like better ting?
Dat's why me too don change base, follow my Oga. From now on, na for dis Steemit I go dey nack una my sweet sweet tory. And na everyday e go dey shele.
NB: Abeg dis ting wey I wan tell you, na secret o. No let anybody hear am yet o, till e happen. Oga Sunny Okim say im wan buy me anoder motor for me make I take dey do my taxi driver work. Dat mean say I go soon trowey dis my guonguoro. Somebody shout halleluya!
Make we jam here again tomorrow
Tank you. Tank you very much. And tank you very very much indeed.

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.12
JST 0.033
BTC 69824.27
ETH 3761.57
USDT 1.00
SBD 3.81