You are viewing a single comment's thread from:

RE: Relationship for Naija

in #naijapidgin6 years ago

Hahaha
Good morning o my piple
How you go turn marriage to contract, na that one crazy pass.
You see for this area way i dey soo, na so so shout everyday for husband and wife oo.
You see, understanding matter big time for any relationship ooo.
But wetin me i see soo be say 50% of this marraige way they they beat there self, the majority be say the husband no pay the bride price, se u dey get me?
Number two be say, the wife use belle tie the man for ground. So mutual understanding no dey, love no dey.
They just gather they commit fornication.
See na only God fit help us oo, for all these relationship matter oo

Me i just dey pass by oo
Una welldone oo

Sort:  

True talk
Thanks @rebeccafl!!!!!
Understanding play one kain ogbonge role for relationship
Nice 👏👏👏

Coin Marketplace

STEEM 0.29
TRX 0.12
JST 0.034
BTC 63687.39
ETH 3309.68
USDT 1.00
SBD 3.93