As E take be for our country

in #npc6 years ago

My naija people I throw way salute to all of una. 


Una welcome to this our account wey we go dey use discus serious tori and even comedy as e take concern Nigeria and Nigerians. 

Today, we go like discuss wetin don dey happen for our naija tey tey. 

Una know say election na next year and na we wey be youth our politicians dey carry do all the yeye jobs. Na we be the future of Nigeria but how we go fit do anything when we dey allow our old papa dem push us anyhow?

Anyways, make we discuss this matter as e take be. 

As our president Gen, Muhammadu Buhari take dey lead us so, una like am?

Wetin be the thing we him dey do wey una like?

Wetin him dey do wey una no like?

Wetin be the advice wey una fit give am to help our naija better?

Wetin be the way forward for our youth of naija?

If a fellow youth say him wan contest una go gree vote for the person? Because I don dey warm up o! Lol! 

Abeg na dis things I go like make we chuk mouth inside today. 

Yarn am as e take dey for your mind. 

Five people wey yarn correct things here go receive 50% percent of the sbd wey we go collect from this post. 


Abeg remember to follow this account, upvotes and Resteem. 

Who fit make avatar for this account for us? Abeg show face. 

Make una help us choose Wetin our next topic go be. Person wey other people happy with him suggestion well well, we go use him topic and him go collect 5% of the sbd wey we go get from the post. 

That man for that picture na Saka my mentor o! Lol!

Image source 

Una doh o! 


Sort:  

Mummy na u oooo
You don come again with sweet sweet thing. Anyway me sef go yarn my own.

hmmm, this one na serious questions o, but make I yan my own sha. the fact remains that even if its me or you dey rule at the moment we go dey complain say things no right and na only baba God fit do the right thing. Say Baba dey do his best o and make we just pray make things better for us when he's still dey rule.

The only thing wey me like we baba dey do na the N'power wey he dey give youth money make den use top belle....Abi at all at all na ehm bad. And all those boko haram people don reduce so he dey try.

The thing wey me no like na how he dey appoint his people for top top post for government and herdsmen wey dey do wayo for people right now e no do anything about it.

My advice for naija be say Make we pray make naija better, make we find something doing like handiwork and make we unite so that naija go better

Wetin be the way forward for our youth of naija?
Make we think big and start small. make each of us engage in little thing that will make money come. our government national cake no fit reach everybody. make we engage in handiwork.

The thing be say, the youth wey we dey talk about, shey that youth sef no wan steal money too cos youth dis days na zobo face dey dea eyes ooo den no send anybody. And hope dey no go turn Aso rock to club house and start to dey dance shaku shaku. To me I go just vote for who I think e go pay us cos only God sabi the best.

Thanks mummy for the love wey you dey show me always. I remain your humblesmith oh sorry humble daughter.

Hmm! Wetin me wan talk be say, no be sey buhari no dey try oo but im matter just be like a tree wey no fit make a forest. Abeg, all the people wey surround the man no allow im effort show. If e give clue say person embezzle money, e no fit just throw the accused for prison nah. Na to give barristers and Chief judges to do dem job. But all this so called Chief judges go dey shift cases till everything die down when dey don collect bribe. Who dey at fault? Na so all this things dey happen for different sectors.

Okay, all this Boko Haram, herds men. Who dey support them? No be dem cliques, so called oppositions. No be all this police dey bother wey ammunitions still dey come in? They no fit do anything cos their Oga at the top don give dem order to allow passage free after e don collect bribery.
So called activist just dey shout future leaders. Them dey show for social media but dem no fit take actions. Them be dogs wey sabi but wey no fit bite, sorry to say but e dey pain me wella.

Wait oo, make I burst your brain small. For this our country, we get better LEADERS amidst our youths than our so called papa wey just dey RULE without qualities of good leadership.

My own advice oo, if all this activist fit put head together or we youths and have a youth political party even if na only two sef, na wahala e go be for this for nothing parties wey dey spoil our country.

As for me oo, I go vote youth ooo. We fit come together do this thing, I tell you. Make we choose correct youths. Wetin this men they do, e sure me sey our youth go do better.

I no say some go dey think sey youth go chop money. Make I tell una, na small small we go eradicate the money wey this youth go swallow compared to this so called our papa wey don swallow devil come dey bury money for sock-away.
Na my mind be dis oo. I dey happy to express myself as this ooo.

Dis government don show us pepper but we sure say our youth go beta?

You don try as you put mouth for this mata.

The thing wey dem show us pass pepper my brother. You go beta, I tell you.

Time don reach wey we take dey yarn matta as e be. As I be so politics no dey concern me because i feel say e no affect me but na lie. E affect me. E affect my papa and mama and e affect my broda and sista. For this we country naija we don suffer no be small.

I never see anything we our president buhari do wey I like o. Make we talk am as e be the man no dey try. He talk say e dey fight corruption but all d money we dey talk say dey recover na where e enter abeg? Okay see our road na so die people dey die there because road no good. If heaven cry water go full everywhere because we no get where the water go from pass. Our clinic them no get beta structure to treat person make e well and this our president know na im make am wen he sick na obodo oyibo he go carry him body go make oyibo dokita treat am. Na so e suppose be?

Our skool nko? Their pikin Dem no dey go skl for we country na obodo oyibo skl na em sweet Dem pass na I'm make wen our teachers Dem for here talk say make Dem do them beta or dey go drop chalk govermenti no go send. Fuel no dey light no dey. Our money no get value again e no fit buy any beta thing and we wey be govt workers no dey increase our salary. Na d same money we still dey collect wey no dey reach anywhere.

I go like make buhari put eye down arrange this nation make e beta. Make e put people wey go work. Make e put money for our schools and hospital and make e stop this nama people wey dey Waka about dey kil people.

Youth our mumu don do. Make we no dey help this people Dem dey do all d bad bad things weyy Dem dey do. Election dey come na we dey go use steal ballot box and kill people abeg our mumu don do. Make we stand for our right and join hand knack this old people comot.

Na we be d future of tomorrow time don reach make be like France get person weyy e blood still fresh as our president. We youth go support the person because we know say e understand wetin we dey go thru. @naijapidgin I throway salute.

@zizymena we throway salute. You don try as you put mouth for this matta.

doh o!

Thanks 4 this oppurtunity @naijapigin
Naija? as dis country tak as in b , me no dey understand oo. C aw awa president dey do us, him 1st stat wit fake promise change d change him get b4 election 4 us .wetin jonatan do 4 subsid neva do? buari cum cos resesion even wen we neva balanc 4 jona wahala. nw shey we don com c wetin petrol dey sey everytin don cost pepsin go get car no fuel. in come cost lik sey we dey find gold and the funali herdsmen wahala stil dey oo,
4 me as Buhari take dey lead us soo me no lyk am, him no even do 1 tin wey pesin lyk. No 1 tin i want mak him do na to solve those herdsmen case bcos alot of people don die and nw i still hear dey neva stop at list mak him do dis. dollar matter him no solve him com dy sey him grt hearing probs.
D only tin i fit sey na mak God save us in this country ,na dis b d no1 tin naija youth fit do. If a fellow youth say him wan contest i go vote mak we give trial , i don tired of dis old men wey dey rule us.

You don try as you put mouth for this matter.

For this matter way day ground so, plenty things day man mouth to talk.

How we go day country where things no day align well and instead make youths day reason way forward, they day campaign for old men way get hand for the kata kata way day ground.

Me, I Don day zero my mind commot all this leaders them because na followers day always decide the kain leader way they get. My own na say make we youths look our self for mirror come yarn ourselves the truth. Wetin be the truth? We no day try.

Everywhere, boys day hustle quick way to make money. No body won develop patience, resilience and ingenuity. No, na how person fit make money na him everybody eye day. This kain shortsightedness no fit help us choose better leaders and develop our nation

The babes themselves day find man way go be their father, brother, sponsor, bouncer in fact everything way an entire village be. After, they go day claim gender equality. They no won learn from how our mama then day do better business bring money come house.

Plus, we still day reason ethnic and religious matter. Once person come from my town, I gat day him back. This kain attitude no fit help us. Old or young, Christian or Muslim, Yoruba, Ibo or Hausa, make we just focus on people way get better vision and support am.

If all of us gather hand say we won change on our own, better leader go come out. After all, no be people like you and me day civil service, police, teachers, etc. I believe say once we don arrange our matter as youth, even if we elect thief as president, the thief go day fear to show him face because everybody day alert and updoing. No body get time for nonsense like tribalism or religious discrimination. But where everyone day wait for messiah, na trouble o. Whether na youth or old man, everyone fit day corrupt. Besides, one man no fit do everything.

The moral of my story be say, a better Nigeria with better leaders day our hand. Maybe how you take appreciate your own property, no him person go take handle am

You don yarn better yarn. Wehdon for this talk wey you put for the matter.

The way this tori dey go,make i just they follow am. I no no say this kind thing go come up for here, i don dey write about naija tori for the past few weeks,you fit check my blog to see for ya self cos naija wahala don tire peson.
Weting me i like about behari be say he dey help us getting the money wey the looter don carry commot from government porch,but i no like the way he dey do am well,because na only those who no dey en party e dey arrest.
Anoda thing i no like about en govenrment be say,he don spoil our economy,before e enter power,person wey dey collect 18k salary fit buy 10 bags of cement with en salary,but now he no fit buy 5.
Before e com to power,he promis us say en go lead d troop go sambisa forest go cinfront bokoharam,he never tell us say he go substitute them with en people. En people done kill with gun,cultlass and knife more than bokoharam do with bomb,n he never see waitin en go do to stop them,en com they tell us make we maintain the peace, i cry for naija

Another thing be say, d way he dey give us xmas bonus on peltrol every year since e com into power dey tire person,we no fit celebrat xmas well well again,we no fit travel.
Another one be say,the way en governor dey whole salary dey too terrible,how person go work for a year without salary? Na only for naija they fit do that.

I don dey talk am,if no youth or new person contest for 2019 election,i no go vote. I no fit waist my time inside sun and still sufer dis kind suffer for four years. For m and for my family no youth or new person,mean no vote.
Let m reserve d rest for una reply,i dey burn well well.... Smile

We don too suffer for naija, wetin you fit advise buhari make edo as e still dey office?
U don try as you put mouth for this matter.

Wetin me fit advice be say
Make en fight corruption generally no b say e go dey fight am at random
Make en enforce his governor to pay salary,he should deal with anyone wey no one comply
He should control en people make they stop killing
And final one be say he should ask for en ministers report,anyone wey no do very well make en ask him to go and make en replace such with young perein wey be say na en field be that. No be say you go bring another lawyer make en day control transport. Smile

Your talk make sense, you don try..

Loading...

My brother ...Na Papa God go bless you for bringing this topic... When e been be campaign time them been talk say de go make naira dey equal to U.S dollar($)..But wetin come happen now be say even if you safe ₦1 from january till december you go only get $1 when the year finish. Nepotism na one thing wey i no like at all for this government. Any young person wey wan take the mantle of leadership...me i go support am fulltime.

#nottooyoungtorun

Make we open eye vote the right person, make these things no dey happen again.

doh o!

na me be dis once again. Make I run yan my own apata make i do am berekete make fifu paduna.

dis our naija,na democracy we talk say we dey do, but stori don change. Our naija youth no dey run and since when i dey small i dey hear am say youth be d leaders of tomorrow but me never use my korokoro eyes see am o.

Wetin i for like be say, make dem allow youth too rule. All dis our old papa dem make them go rest and just dey allow youth do am and rest to just dey give advice.

Na weitin we want for Naija, make our old papa gree our youth to rule, make it be better youth no be person wey go destroy our nation.

You don try..

true talk. Because our youth self their blood kukuma don dey corrupted. My conclusion be say make God come make dis world end

My brother/sister d mata con tire me o infact this country sef tire me join... Day talk wey u say young person mk e be presido for we kwantri me sef tell u say we young pipo no go gree vote young person why na greed!! N yes tout go still dey unto say money dry n person no go see money say no to am.

My own always be say mk we young people find sontin do for we self.... Start with 1k/day soon u go d see 5k so money no go carry u go grave.

Anyway laslas I no tink say buhari go win again Wetn I for like add be mk we youths try choose person wey go benefit us carry we all along else e go still remain laidis

Okay the talk for next time suppose be "how we fit better ourselves for this kwantri... Wetn oyinbo d call entrepreneurship"

True talk, Make our young people dey try help themselves.

You don try..

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 61143.11
ETH 2928.78
USDT 1.00
SBD 3.56