PERSON SLAP YOUR MAMA, WETIN YOU GO DO?

in #naijapidgin6 years ago (edited)

oaEY5Y9.jpg
My naija people Happy Valentine's Day!

I hail una o.

We don land again with valentine special.

Una know say we don too talk about government, so we come decide say make we talk about this life wey we dey so

Una know say na love season we dey so, and na Mama love wey be highest after Baba God.

You know say if you start to dey think wetin your mama don do for you, you no go fit count am.

Walahi, the suffer wey she don suffer to make your life better.

Some people, their mama dey even sell market for sun, to pay their school fees. Our mama dey try wella!!

Na so you just dey one day, you come see or hear say person slap your Mama, chai!

Wetin you go do?

If the person old pass your mama, that is if na elderly person,

How you go handle am?

If the person na young person,

How you handle am?

What if your mama come dey at fault, and you dey do born again

How you go handle the matter as born again wey you be?

Make una help me answer abeg

Abeg make una help me reason this matter. Make una try make am brief!

nigeria-women-e1413134872917.jpg
source

Our discussion go continue for our telegram group. Remember say na there everything dey happen. If you never join, join here.

Our admins don decide say na dis people qualify to collect 50% of our liquid payout for the last post. @dante1, @perkyeunice, @fadiji09, @iamthegray and @horlaide.

If you wan join begin follow make this kind decision, join us for telegram for here. We go dey start discussion around 10 pm everyday. But we fit adjust time to any one wey una suggest.

Na @daniel-otaniel choose dis topic wey we discus so. So, 5% of the liquid payout na his own. If you wan win the next one, join us tonight to discuss wetin our next topic go be.

Walahi, E no easy to pick this winners because everybody yan better for dat tori. We go dey use our telegram group to decide better.

Five people wey yarn correct things here go receive 50% percent of the sbd wey we go collect from this post.
No mind say ein small now, very soon e go big well well.

Abeg remember to follow this account, upvotes and Resteem.

Na for telegram we go dey choose our topics. First person to pick topic wey others agree with go get 5% of the liquid payout.

Abeg all the naija pidgin lovers make do quick quick go join the telegram group for here.
Our Telegram: naijapidgin

Oya make una yarn am as e take be for una mouth.
Una doh o!

Sort:  

As it go be , person wey slap my mama go chop am finish..

Goodday to all of una o and I thank you for d love wey una don dey show me since wen this contest don start.
@ogoowinner wetin u don yarn wey concern our mana dey touching , the word touch ma heart as if say na d first time wey I dey hear am be dis, make ur intelligence sha dey grow wel wel.

  • The thing wey I go do if I see or make person yarn me say dem don light my mama face, na d level simple pass, na jex for me to see him/ her, if I don ask am say 'se na u do am abi sey na u light my male face, u wan come show say God dey ur back and talk YES, I swear I go strip ur naked, comot all ya cloth ,disgrace you + generation wey dey follow u.

  • If the person old pass your mama, that is if na elderly person.
    How you go handle am?
    Chai, dis one strong. Make I dey loyal, as I dey like dis , I no dey give any person any approch wey no make sense, but it u try am I go enter u finish.
    As d case don be and it come concern my mama u cone dey voice nonsense say u old , infact i go insult and curse ur generation.

  • If na younger person person im no get any option other dan say he don die. If I no fit handle am, I go hire person wey be say im life assurance go remain 40% lol

  • What if your mama come dey at fault, and you dey do born again
    How you go handle the matter ?
    Y dis last question come thick like dis ( born again+ at fault)
    I go console the both party and beg my mama make she dey calm.

Thanks for the challenge @naijapidgin @ogoowinner

Ewooo!! Person gather morale slap my mama, if I dey dia wey dis kain tin happen, I no wan your age oh,even if you senior my mama I go change am for you. I go use mouth finish your generation. Sha I no fit beat elderly person. But say na small person, Chimo!!! Im own don finish. I go beat beat am sotey dat demon wey give am morale to slap my mama go commot for im body. Wen next im hear slap e go dey cry.
E come be say I be born again, Fada lord help me becos na dat day my born again end oh. God no fit fight dis kain battle for me.
If say my mama dey at fault, I go still ginger for outside sha, i go shake ground. but wen we enter domot I go reason my mama say she no try oh, but sha I still get her back.

Happy val my country people I trowey ogbonge salute for unah.
Hmm if somebody slap my mama aaahh
D truth b say if I senior the person I go beat d person and make sure say him apologize to my mama even if nah my mama dey at fault I go make am understand say this part of the world wey we dey e no good to d fight elderly person,
And if d person senior me aah we go die for there o I go make am know say em fuck up plenty and him no suppose slap my mama base on say my mama still senior.
They gats know say my mama nah my everything any how d matter b.

Anything wey enter mama matter, we suppose carry a play.

you don try as you put mouth this matter

Before I contribute my own, make I trowey salute to @daniel-otaniel. E no dey easy to think out topic like dis one. Three Twale for you.
my pipu, talk dey here o, one thing about mother be say, you no fit get two mothers,
Your father second, third or fourth wife no fit be your mother. If your mother still dey alive you need to defend her for anyhow the mata be.
me as I dey like dis, nobody go touch my mama go free o. Nine months no b nine days or weeks.
I go make sure say the mats go far. Because my own mama no the find anybody wahala. I go make sure say that person pay for wetin e do. As I dey like dis, to beat old person no dey my blood. I go just find the nearest police station put the person make e smell the iron small if the person old o.
younger person no fit try slap my mama nah, if e happen wen I dey airport and the time for my flight Don reach, I go cancel the flight just to make sure say I teach that person how to respect mothers. The way I go beat the person #naijapidgin go carry the tori

Nine months no be nine days, person no go just come dey disrespect our mama.

If person slap me sef, I no go gree, not to talk of my mama wey don suffer for me.

I no like to dey fight o because that one dey risky and e fit land the person in trouble, besides two wrongs no make a right.

But I no go fit let the person go like that lie lie... I go shout for am ... If the person no come apologise, I go use my verbal power destroy am

True talk, two people wey dey wrong no fit dey right, but if na peson wey get sense, e suppose come tell you no be to slap am.

I go like make the person try oo

If u slap me sef I no get chill

E don tay xha

Since I don accept christ..... If u slap me I no go do anything and I no sure say my mama go do watin go make person slap am

And if your mama fit do watin make them them slap am..... Check ur mama sef.. She go don fuck up

Mama na mama ooo but anybody wae fit slap person mama na big idiot

True talk, anyone wey fit slap person mama no be better person.

Exactly no b better person at all

Some pipu no send oh.

On top my side if persin wey feel sey him don chop beleful go touch my mama na die be dat nai.
If you d younger dan my mama n she no dey wrong your own don finish partata on the oda hand if she dey wrong I go still change am for you but when we leave dei eh I go call my mama tell sey wertin she do no good.

If nai persin wer senior my mama n she no dey wrong nai to carry army n police follow am but if my mama dey wrong I go still arrest am with Police for assault.

Anyhow anyhow person touch my mama wrongfully or rightfully him must pay.

Nai my own submission be dat.

anyhow anyhow, we go fight for our mama, because she be everything.

u talk well, welldone.

Happy val o my people, my momma na my everything.no matter what
Even if i knw say she dey at fault sef, i go still fight like mad, cos she don suffer alot on the poor me....

If the old pass your mama, how you go take fight?.

Una doh oo...

Dis matter no be here oo

my mama na my life, so if person touch her, na me dey person touch be that, so if person slap my mama and i come see am as him dey slap my mama, i swear i no go remember say law dey ooo, i go too slap d person ehn...slap him generation join sef. But if say na hear i hear am, na to go carry police oo and if i see say police no do anything, u no say na naija we dey, i go arrange boys make help me teach the person lesson.

If d person come old pass my mama

na to carry the matter go meet them police people and i go make sure say dem teach d person correct lesson wey he no go fit forget for him life

If my mama dey at fault and i come be born again

first dt born again issue ehn, na story, so because i be born again, person go come slap my mama? No try am oo, if i see d person as e dey slap am, i go forget say i dey go church oo, i go beat d person ehn..... E no matter if na my mama dey at fault, d only time wey i no go fit do anything na if na my mama first slap d person.

Na my own answer be that, i still dey salute una, una weldon.

`If i go talk truth eh,
if the pesin old pass my mama
I go change am for the pesin, let am kno say me no gbadu the matter.
If na young pesin
Me go woza you better slap,ein fit no be d best tin to do but i no send, as in u go chop better beating. I no dey joke with mumci
Even if she dey wrong
I gat mama's back 100% , maybe when we reach house i go tell am for house say no be so .

Omo na so ein take dey for my own mouth
I love my mama
Ho-Ha!

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 65262.74
ETH 2937.20
USDT 1.00
SBD 3.68